Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 22

1 "My brodas and fadas, mak una hear mi as I dey difend mysef."

2 (Wen dem hear sey e dey tok to dem wit Aramaic language, dem kon kwayet wel-wel.) Den Pol sey,

3 "I bi Ju wey dem born for Tarsus wey dey Silicia, bot na for dis tawn I for grow, I go school and learn awa gran-gran papa dem law wel-wel unda Gamaliel and I get maind to serv God wel-wel, jos as una bi today.

4 "I sofa Kristens and I dey kil pipol wey dey serv God, dey tie pipol trow for prizin, weda dem bi man or wuman

5 and ivun di High Prist and di kansol eldas no abaut mi. From dem, I kolet leta go giv dia brodas wey dey for Damaskus, so dat I go arres pipol wey biliv Kraist kon bring dem kom Jerusalem put for prizin.

6 "As I dey go, near Damaskus, aroun aftanun, won kaind lite from hevun kon shine roun mi.

7 "Den I fal for groun kon hear won vois wey sey, 'Sol, Sol, why yu dey ponish mi?'

8 "I ansa, 'Hu yu bi Oga?' E kon sey, 'I bi Jisos Kraist wey kom from Nazaret, wey yu dey ponish.'

9 "Di pipol wey folo mi si di lite, bot dem nor undastand di vois wey dey tok to mi.

10 "So I ask am, 'Oga! Wetin yu wont mak I du?' Di Oga ansa, 'Get up mak yu go Damaskus; for der, dem go tel yu evritin wey God don shuz sey yu go du.'

11 "Bikos of haw di lite shine for my eye, I nor fit si again, so di pipol wey dey folo mi kon hol my hand go Damaskus.

12 "Won man wey dem dey kol Ananias, wey dey holi and dey serv God akordin to di law and di Ju pipol wey dey stay der, dey tok gud abaut am.

13 "Na di man kom mit mi, stand near mi sey, 'Broda Sol, mak yu bigin si again!' So for dat same taim, I luk up kon si-am.

14 "Den e sey, 'God wey awa gran-gran papa dem serv don alredi shuz yu to du wetin e wont and to tak yor eye si di Raitious Pesin. So mak yu hear and listin to am,

15 bikos yu go bi en witnes to all di pipol, abaut wetin yu don si and hear.

16 'Naw, wetin yu dey wait for? Get-up, mak dem baptaiz yu, so dat God go forgiv yu yor sin, as yu kol en name.

17 "Wen I go Jerusalem bak and dey pray for di Tempol, I kon si vishon

18 and Jisos Kraist sey, 'Mak yu komot for Jerusalem kwik-kwik, bikos dem nor go asept wetin yu dey tok abaut mi.'

19 "I ansa, 'Oga, dem diasef no sey I dey beat and trow pipol wey biliv yu put for prizin.

20 "And wen dem kil yor savant Steven, I stand der sopot dem kon kip dia klot for dem.'21"Bot di Oga sey, 'Go, bikos I go send yu go far-far go mit Gentai pipol.'"

22 As e tok finish, pipol wey gada dey listin to am kon dey shaut, "Kari dis man komot! Mak dem nor alow am liv!"

23 As dem dey shaut dey ves pul shirt and trowey san-san,

24 di komandin ofisa kon giv orda sey mak dem tak Pol go insaid barrak. E sey mak dem flog and ask Pol kweshon, so dat dem go fit no why di pipol dey shaut for Pol head laik dat.

25 Wen dem don put am for groun mak dem start to flog am, Pol kon ask di soja wey stand near am, "E dey rite mak una flog pesin wey bi Roman citizin, wen dem neva joj en kase?"

26 Wen di soja hear dis, e go tel di komandin ofisa, "Wetin yu won du so? Dis man kom from Rome o-o."

27 So di komandin ofisa ask Pol, "Tel mi, yu bi Roman citizin?" Pol ansa, "Yes."

28 Di komandin ofisa kon sey, "Na big moni I spend to bi Roman citizin." Pol ansa, "Bot dem born mi for Rome."

29 Den doz men wey bi won ask am kweshon kon komot and fear kash di komandin ofisa wen e no sey Pol, wey dem tie, na Roman citizin.

30 Di next day, bikos di komandin ofisa won no di rizin wey mak di Ju pipol dey akiuz Pol, e riliz am kon orda di prist oga dem and di hol kansol mak dem gada. So e bring Pol kon stand for dia front.

Open Bible reader