Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 19

1 For di same taim wen Apollos dey Korint, Pol travol pas insaid tawn ontil e rish Efisos. For der, e mit som disaipols

2 kon ask dem, "Una don risiv di Holi Spirit, since una don biliv Kraist?" Dem ansa, "No! Wi neva ivun hear sey Holi Spirit dey."

3 Pol ask dem, "Na haw dem kon tak baptaiz una?" Dem ansa, "Na Jon baptism."

4 Pol kon tel dem, "Jon baptaiz pipol wey turn from sin kom mit God wit wota kon tel dem mak dem biliv di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jisos Kraist."

5 Wen dem hear wetin Pol tok, dem kon baptaiz dem wit Jisos Kraist name

6 and as Pol put hand for dia head, di Holi Spirit enta dem and dem kon start to speak difren language, dey profesai.

7 (Na twef disaipols Pol folo tok.)

8 So Pol enta di sinagog kon dey tok wit boldnes for tiri monts. E dey show di pipol haw dem go tak biliv God Kindom.

9 Bot wen som of di stuborn pipol nor gri biliv, dem kon dey spoil Jisos Kraist name for all di pipol front, so Pol wit en disaipols kon liv dem. Pol kon dey tak en disaipols folo bodi evriday, go tish for Tiranus Hall.

10 Dis tin kontinu for tu years ontil evribodi wey dey stay for Asia aria, weda na Ju or Greek, hear God wod.

11 Dat taim, God yuz Pol dey du meni wondaful mirakols,

12 ivun handkachef and klot wey dem tak tosh Pol bodi, dey heal sik pipol and driv evil spirit from pipol bodi, wen dem yuz am tosh dem.

13 Bot som Ju wey dey waka abaut kon trai to kol Jisos Kraist name for pipol wey evil spirit dey disturb dey sey, "I kommad yu wit Jisos Kraist name wey Pol dey prish."

14 (So, Skeva wey bi Ju prist, get sevun sons wey dey du dis kaind tin.)

15 Bot di evil spirit ansa dem, "Yes! I no hu Jisos Kraist bi, I stil no Pol tu, bot hu una bi?"

16 Naim di man wey di evil spirit dey insaid en bodi kon jump for dia bodi beat dem wel-wel, ontil dem start to beg. E beat dem til dem run komot from di haus wit nakednes and all dia bodi ful wit sore.

17 Wen evribodi wey dey stay Efisos, both Ju and Greek, hear di stori, fear kash dem and Jisos Kraist name kon dey reign.

18 Meni pipol wey nor biliv, kom out kon dey konfes all di bad tins wey dem dey du.

19 Som wey dey du magic, bring all dia books kon burn dem to ashes for evribodi front. Wen dem add di price for all di books, e rish fifti tazon silva koins (50,000). 20 So God wod kon dey grow more-more and dem kon dey win meni souls.

21 Afta all dis tins hapun, Pol kon sey e go-go Jerusalem tru Masidonia and Akaya. E plan sey, "Afta I don rish der, I go stil go Rome."

22 So, afta e send tu men wey dey help am, Timoti and Erastus go Masidonia, e kon stil stay Asia smol.

23 Dat taim serious wahala hapun bikos of "Kraist Way" wey dem dey prish.

24 E get won man, en name na Demetrius and e dey mod silva image. Na dis man mod Artemis shrine and dey help pipol wey dey mod, mak plenti moni.

25 Di man kon gada all di pipol wey dey mod, wit oda men wey dey du dat kaind wok, den e tel dem, "My pipol, una no sey na dis biznes wi tak dey chop.

26 And una don si and hear sey dis Pol don tak meni pipol komot from awa hand. Nor bi onli for dis Efisos, bot for di hol Asia, bikos e dey tel dem sey di gods wey dem mod, nor bi god at-all.

27 "So, if wi nor du somtin, awa biznes go spoil and nor bi onli dat won, bot pipol nor go respet di tempol wey awa juju, Artemis, dey stay again and dis wuman wey di hol Asia dey woship, nor go get pawa again."

28 Wen di pipol hear dis tins, dem ves wel-wel kon start to shaut, "Artemis wey dey Efisos, na yu bi awa god!"

29 Di hol tawn kon dey shake wit nois and all di pipol rush go di stadium dey drag Gaius and Aristakus and di Masidonia pipol wey dey eskot Pol.

30 Bot wen Pol won enta di stadium, di disaipols nor alow am.

31 Ivun som of di oga dem wey bi en frend, send mesage go mit am sey, mak e nor enta di stadium.

32 Na so all di pipol dey shaut enihaw and konfushon kon ful evriwer, meni pipol wey gada dey shaut, nor ivun no why dem gada.

33 Som pipol sey na abaut Alexander, bikos di Ju pipol don push am go front. Alexander wave en hand kon sey, mak dem kwayet, mak e for fit tok to difend di Ju pipol.

34 Bot wen dem si sey na Ju e bi, dem kon start to shaut again, "Artemis wey dey Efisos, na yu bi awa god!" Dem shaut laik dis rish tu hours."

35 Afta di tawn secretary don mak di pipol kwayet, e kon sey, "My pipol wey dey Efisos, wish pesin dey among una wey nor no sey na Artemis bi Efisos god wey fal from hevun?

36 "So bikos nobodi fit argue dis mata, mak una kwayet and mak una nor du enitin wey nor get head.

37 "Una don bring dis men kom here, nor bi bikos dem spoil di tempol or kos awa goddess.

38 "If Demetrius and di pipol wey dey wit am get eni komplain against enibodi, kourt dey and joj dem dey der tu. So mak dem tak dia kase go der.

39 "Bot if una wont enitin wey pas dis won, na kourt dem go for setol am.

40 "Bikos dem fit tak all of us go kourt today sey wi dey riot, bikos wi nor get eni rizin for dis konfushon wey dey hapun so."

41 Afta e tok finish, e kon sey mak evribodi go dia haus.

Open Bible reader