Nigerian Pidgin Bible
Acts 13
1 Dis na di profets and tishas wey dey di shosh for Antiok: Banabas, Saimon wey dem dey kol Niger, Lucius wey kom from Syrene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak frend from smol pikin) and Sol.
2 As dem dey fast and woship God, di Holi Spirit kon tel dem, "Mak una seprate Banabas and Sol for di wok wey I want mak dem du."
3 Afta dem don fast and pray finish, dem pray for Banabas and Sol kon send dem go.
4 So Banabas and Sol wey di Holi Spirit send kon go Seleucia and from der, dem enta ship go Syprus.
5 Wen dem rish Salamis, dem kon dey prish God wod for di Ju sinagog, (Jon dey der dey help dem.)
6 Wen dem don kros di hol Island go rish Pafos, dem kon si won magician wey bi Ju and na wayo profet. En name na Bar-Jisos,
7 e dey wit Sergius Paulus, wey bi Roman ofisa and e no book wel-wel. Di ofisa invait Banabas and Sol kom en haus, bikos e won hear God wod.
8 Bot "Elymas" wey bi magician, (bikos na wetin en name min bi dat) kon dey opoz dem, so dat di Roman ofisa nor go biliv wetin dem dey prish.
9 Bot Sol (wey dem dey kol Pol) wey get di Holi Spirit, luk Elymas for face
10 kon tel am, "Yu devol pikin wey nor laik gud tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi du, yu nor go stop to dey opoz God?
11 "Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for somtaim!" At wons, e eye jos blind and daknes kova en face and e kon dey tak hand faind pipol mak dem show am road.
12 So wen di Roman ofisa si wetin hapun, e kon biliv, bikos e sopraiz wel-wel for wetin dem tish abaut Jisos Kraist.
13 Pol and di pipol wey folo am kon travol from Pafos go rish Perga wey dey for Pamfilia, bot Jon Mark liv dem kon go bak to Jerusalem.
14 Wen dem komot for Perga, dem rish Antiok for Pisidia for Sabat Day kon enta di sinagog go sidan.
15 Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send mesage go mit dem sey, "Awa brodas, if una get eni mesage to tak enkorage di pipol, mak una kon tok naw."
16 So, Pol stand-up raiz en hand kon sey, "Izrel and Gentai pipol wey dey fear God, mak una hear wetin I won tok:
17 "Na from Izrel pipol God shuz awa gran-gran papa dem and E kon mak dem great for di taim wey dem stay for Egypt as strenja and E kari dem komot from Egypt wit en own hand.
18 "For forti years, E stay wit dem for insaid widanes.
19 "Afta E don destroi sevun tribes for Kanan, E kon dash en pipol di land.
20 "All dis tins hapun for for ondred and fifti years. Afta dis, E kon giv dem profet wey go joj dem, ontil Profet Samuel taim rish.
21 "Di pipol kon ask for king and God giv dem Sol, wey bi Kish pikin, wey kom from Benjamin tribe and e rule dem for forti years.
22 "Afta God rimov am, E kon mak David dia king. Na dis man God tok abaut sey, 'I don si David, Jesse pikin, di man wey I laik wel-wel and e go du evritin wey I wont.'
23 "Na from dis man famili God giv Izrel, Jisos Kraist, di savior wey E promis dem bifor.
24 "Bifor Jisos kom, Jon don prish to all Izrel pipol sey mak dem turn from sin kom mit God and mak e baptaiz dem.
25 "Bot as Jon dey finish en wok, e kon tok meni taims sey, 'Wetin una tink sey I bi? Nor bi mi bi di Mezaya. Mak una si, sombodi dey kom afta mi. I nor rish to rimov shu from en leg!'
26 "So my brodas, wey bi Abraham shildren and una wey bi Gentai pipol wey dey fear God, na di mesage abaut haw God go tak save pipol, naim wi kom tel una so.
27 "Bikos di pipol wey dey stay for Jerusalem and all di rulas nor no am, so dem kon yuz wetin dem dey read for Sabat, wey di profets tok, tak kil-am.
28 "Dem nor si enitin wey go mak dem kondem am, bot dem stil tel Pilate mak e kil-am.
29 "Wen dem don du evritin wey Bibol tok abaut am, dem bring am dan from di kros kon put am for grave.
30 "Bot God raiz-am from deat
31 and for meni days, e apier to di pipol wey dey folo am from Galili go rish Jerusalem. Na dis pipol kon dey bear witnes sey, dis tins na tru.
32 "And wi dey tel una di Gud News abaut dis tins wey God promis awa gran-gran papa dem.
33 "E don du wetin E promis us and dia shildren, wen E raiz Jisos Kraist, as dem rite am for Psalm sey, 'Yu bi my Son and today, I don bi yor Papa.'
34 "Bot bikos E don raiz Jisos Kraist from deat mak e nor for rotin, God kon sey: 'I go giv yu di holi promis wey una fit trust, wey I promis David.'
35 "E stil tok for anoda Psalm sey, 'Yu nor go alow yor Pikin wey dey holi, mak e rotin.'
36 "Bikos David, afta e don du wetin God send am kon du among en pipol, e kon die and dem bere am wit en gran-gran papa dem and e rotin,
37 bot di pesin wey God raiz-up, nor rotin.
38 "So my pipol, mak una no sey, na tru dis Pesin wi dey prish sey, 'God go forgiv una.'
39 "Tru am, evribodi wey biliv, go dey fri from evritin wey Mosis law nor fit fri dem from.
40 "So mak una mak sure sey wetin di profets tok for groun, nor hapun to una:
41 "Una wey dey laff; mak una hear, una go sopraiz til una die! Bikos I go du somtin for una taim, somtin wey una nor go biliv ivun if dem tel una."
42 As Pol and Banabas dey komot, di pipol kon dey beg dem mak dem stil kon tok abaut all dis tins for di next Sabat Day.
43 Wen di mitin for di sinagog don finish, meni Ju and Gentai pipol wey dey fear God kon folo Pol and Banabas, dey enkorage dem sey, mak dem kontinu for di grace wey God giv dem.
44 Di next Sabat Day, nearli evribodi for di tawn gada mak dem for hear God wod.
45 Bot wen di Ju pipol si as di pipol plenti rish, jelosi kon ful dia maind, so dem start to opoz wetin Pol dey tok kon dey kos am.
46 Pol and Banabas kon yuz boldnes tak ansa dem, "E gud sey na una wi first prish God wod giv. Bot since una rejet am and una nor redi to get life wey nor dey end, wi go-go prish giv Gentai pipol.
47 "Bikos dis na wetin God don alredi komand us sey: 'I don shuz una to bi lite for Gentai pipol, mak una bring salvashon kom dis wold.'"
48 Wen di Gentai pipol hear wetin e tok, dem start to hapi kon dey tank God for en wod and evribodi wey God don shuz to get life wey nor dey end, kon biliv.
49 So God wod kon dey spread roun di hol kontri.
50 Bot di Ju pipol tok bad tins abaut Pol and Banabas giv all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di tawn, so dem sofa dem and driv dem komot from di aria.
51 So wen dem don shake di land san-san wey dey dia leg komot, dem kon go Ikonium.
52 So di disaipols begin hapi and di Holi Spirit kon ful dia life.