Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 10

1 Won man wey en name bi Konilios dey stay for Sizeria and e bi ofisa for Itali armi.

2 E dey holi and en and en famili dey woship God. E dey help di pipol wel-wel and dey pray to God evritaim.

3 Won day, aroun tiri o' klok for aftanun, e kon si vishon and God angel kol am, "Konilios."

4 Fear kash am as e dey luk di angel, so e ansa, "Oga, Wetin yu wont?" Di angel tel am, "God don hear yor praya and si all di gud tins wey yu dey du for poor pipol.

5 "So, send som men go Jopa mak dem go kol won man wey en name bi Saimon Pita.

6 "Di man dey stay wit Saimon wey dey du leatha wok and di haus dey near di sea."

7 Wen di angel don go, Konilios kon kol tu of en haus boys wit won soja wey dey serv am

8 and wen e don tel dem evritin wey hapun, e kon send dem go Jopa.

9 For aftanun for di next day, as di men dey near di tawn, Pita kon go di haus top go pray,

10 afta som taim, e kon dey hungri, bot di fud neva redi. As e dey wait, e kon si vishon.

11 E si sey hevun opun and somtin wey bi laik tray, wey dem hol for en for kona kon dey kom dan smol-smol.

12 Difren-difren animas wey get for legs and di wons wey dey krip for groun and difren birds dey insaid di tray.

13 Den won vois tel am, "Pita, get up, kil mak yu chop."

14 Bot Pita ansa, "Oga, I nor go fit, bikos yu no sey since dem born mi, I neva chop enitin wey get blood or wey nor klin."

15 Bot di vois tel am, "Wetin God don mak klin, mak yu nor forbid am."

16 Dis tin hapun tiri taims and di tray kon go bak to hevun.

17 As Pita stil dey wonda wetin di vishon min, di men wey Konilios send kon rish Saimon haus.

18 Dem ask if enibodi wey bi Saimon Pita dey di haus.

19 As Pita stil dey tink abaut di vishon, di Holi Spirit kon tel am, "Luk!, tiri men dey faind yu.

20 "Mak yu get up go mit dem and mak yu folo dem, bikos na Mi send dem kom."

21 So Pita go dan go mit di men kon sey, "Na mi bi di pesin wey una dey luk for. Wetin bring una kom?"

22 Dem ansa, "Konilios, di armi ofisa, wey dey du gud tins and dey woship God wel-wel, wey all di Ju pipol dey respet, na-im send us kom. Won angel komand am sey mak e invait yu kom prish giv am."

23 So Pita sey mak dem enta haus and e welkom dem wel-wel. Di next day, e kon folo dem go and som brodas for Jopa, folo am go tu.

24 Afta dem don travol for won ful day, dem kon rish Sizeria. Konilios don gada all en famili and frends dey wait for dem.

25 So as Pita enta di kompound, Konilios nil dan for en front kon dey woship am.

26 Bot Pita hol am kon sey, "Stand up, bikos I bi ordinari humanbin laik yu."

27 As Pita stil dey folo am dey tok wen e enta di haus, e kon si sey meni pipol gada dey wait am.

28 E kon tel dem, "Una no sey di law nor alow us, wey bi Ju pipol, to visit Gentai pipol or folo dem du enitin, bot God don show mi sey mak I nor sey enibodi nor dey klin.

29 "Na dis mak wen una send pipol kom kol mi, I nor sey 'No'. So mak una tel mi, 'Why una kol mi?'"

30 Konilios ansa, "For days ago, for dis kaind taim for aftanun, as I dey pray for my haus, won man wey en dress dey shine kon stand for my front.

31 "E kon sey, 'Konilios, God don hear yor praya and E don rimemba all di gud tins wey yu dey du.

32 'So mak yu send pipol go Jopa go kol Saimon, wey dem dey kol Pita. E dey stay as visitor wit Saimon wey dey du leatha wok, wey e haus dey near di sea.'

33 "So, I kon send pipol go kol yu and yu du wel as yu kom. Na wi bi dis for God front, wi redi to hear wetin E sey mak yu tel us."

34 Den Pita tel dem, "Naw, I don undastand sey God nor dey opres enibodi,

35 bot for evri tribe, di pesin wey fear am and dey du wetin gud, na dat pesin, E dey laik.

36 "Una no di mesage wey E send to Izrel pipol, wen E tok abaut di Gud News wey dey giv peace, tru Jisos Kraist, di ril Oga.

37 "Una no wetin hapun from Galili go rish Judea afta Jon prish sey,

38 Jisos Kraist wey kom from Nazaret, na-im God giv di Holi Spirit and pawa. Haw e kon du gud for evriwer kon heal pipol wey devol dey opres, bikos God dey wit am.

39 "All of us si di tins wey e du for Judea and Jerusalem. Dem hang am for tri kon kil-am,

40 bot God raiz-am for di ted day kon alow pipol si-am.

41 "Nor bi evribodi si-am, bot na di wons wey God don shuz, wey folo am chop and drink afta e don wak-up from deat.

42 "E kon komand us mak wi prish and warn pipol sey, na en ensef bi di Pesin wey God shuz mak e joj pipol wey dey alaif and di wons wey don die.

43 "All di profets tok abaut am sey, 'Evribodi wey biliv am, tru en name, God go forgiv dem.'"

44 As Pita stil dey tok, di Holi Spirit kon enta insaid all di pipol wey dey hear di mesage.

45 Di bilivas wey bi Ju wey folo Pita go Jopa kon sopraiz wel-wel sey Gentai pipol tu, fit risiv di Holi Spirit,

46 bikos dem dey hear wey dem dey yuz difren-difren language tak dey praiz God. Den Pita sey,

47 "Enibodi go fit sey mak wi nor baptaiz all dis pipol wey don risiv di Holi Spirit, jos laik di res of us?"

48 So e sey mak dem baptaiz dem for Jisos Kraist name. Den di pipol sey mak e stay wit dem for som days.

Open Bible reader