Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 9

1 Na di trut I dey tok, na Jisos get mi and di Holi Spirit dey bear witnes for my maind sey, I nor dey lai wen I sey,

2 e dey pain mi for maind and sorrow ful my heart,

3 bikos I for laik sey God go kos and seprate mi from Kraist, so dat my own flesh and blood,

4 wey bi Izrel pipol, go fit asept Kraist. Na dem God shuz as en own shildren, E mak agriment wit dem kon giv dem en law. Na dem get di Tempol and wetin God promis.

5 Awa gran-gran papa dem wey folo God waka bifor, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray mak dem praiz God wey dey rule evritin foreva and eva! Amen.

6 Nor bi sey God promis don fail; bikos nor bi evribodi wey dey Izrel rili bi God pipol.

7 And nor bi all Abraham pikin bi God shildren. Insted, God tel Abraham, "Na tru Izik yu go get di shildren wey I promis yu."

8 Dis min sey di pikin wey Abraham born (Hagar pikin, Ishmael) bifor God promis am, nor bi di won wey God shuz. Insted, di pikin wey e born tru God promis, na dat won bi Abraham tru pikin.

9 Bikos na so God tok for en promis, "Wen di taim don rish, I go kom bak and Sarah go born boy."

10 Nor bi onli dat, bikos Rebeka shildren na won papa dem get and naim bi awa gran papa, Izik.

11 Ivun bifor dem born di shildren or sey dem du eni bad or gud tin, God tel Rebeka, "Di senior pikin go serv en junior broda, so dat my promis go stand:

12 nor bi bikos of wetin dem du, bot na as I wont mak e bi."

13 Jos as God wod sey, "I luv Jacob, bot I hate Esau."

14 Wetin wi go tok? God dey show parsha? No!

15 Bikos E tel Mosis sey, "I go sori for hu I won sori for and I go show mesi to hu I laik show mesi to."

16 Derfor, evritin dey for God hand, nor bi by wetin pipol won du.

17 God tel Fero for en wod sey, "I mak yu king, so dat I go yuz yu show my pawa and pipol go fear my name for di hol wold.

18 So, God dey sori for hu E won sori for and dey ponish hu E won ponish.

19 I no sey yu go ask sey, "Wetin mak God dey faind fault for pipol bodi, since na-im mak us dey du as wi dey du?"

20 Bot, my frend, I dey ask, "Hu yu tink sey yu bi, wey mak yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, 'Why yu dey mold mi laik dis?'"

21 Di man wey mold di pot fit yuz di clay as e laik. E fit yuz di clay mak tu pot, won for big parti and di oda won for haus.

22 Bot God won show sey E dey ves, so E kon yuz en pawa against doz wey E won ponish.

23 E dey du laik dis to show en glori wen E piti for pipol wey E shuz to show en glori.

24 Weda wi bi Ju or Gentai pipol, E don shuz us.

25 As E tok for Hosea book sey; "Doz wey nor bi my pipol bifor and di pipol wey nobodi luv bifor, I go kol dem, 'Di pipol wey I luv.'

26" For wer God for tel dem sey, 'Una nor bi my pipol, na der dem go stil kol dem God shildren.'"

27 And dis na wetin Isaia tok abaut Izrel pipol, "Izrel shildren meni laik san-san wey dey wotasaid. Bot na few of dem, God go save.

28" Bikos God go kwik du wetin E sey E wont du for dis wold, E go kom joj di wold."

29 Jos as Isaia tok bifor sey, "If to sey Almighti God nor save som for awa shildren, wi for don die finish laik Sodom and Gomora."

30 Wetin wi go tok? Ivun doh Gentai pipol nor dey raitious bifor, dem don dey raitious naw, bikos of fate.

31 And Izrel pipol wey dey trai to du wetin God wont, nor fit du-am.

32 Why dem nor fit du-am? Na bikos dem dey trai to du gud laik sey na by wok, nor bi wit fate. Na dis mak dem dey strogol kon dey fal on-top stone.

33 God wod sey, "Si, for Zion, I dey arange stones wey go mak pipol fal, yet doz wey biliv am, E nor go disapoint dem.

Open Bible reader