Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 16

1 I get beta tins to tok abaut awa sista, Fibi, wey bi lida for di shosh wey dey Senkria.

2 Mak una welkom am wit God name as God shildren sopoz du. And mak una giv am enitin wey e nid; bikos e don help mi and oda pipol bifor.

3 Mak una salot Prisila and Akwila for mi. Dem bi my co-wokas for awa Oga Jisos Kraist wok,

4 dem don ivun risk dia life bikos of mi. So, mi and di hol shosh dey tank dem wel-wel.

5 Mak una stil help mi salot di pipol for di shosh wey dey mit for dia haus. Salot Epaenetus, my gud frend (di first pesin to biliv Kraist for Asia).

6 Grit Mary wey don wok wel-wel wit una.

7 Mak una grit my kozin Andronikus and Junia wey dey prizin wit mi bifor. Di apostols dey respet dem and tu of dem don dey folo God, bifor I ivun no Kraist.

8 Grit Ampliatus, wey get fate and e bi my very gud frend.

9 Grit Urbanus wey folo us wok. Grit Stachys wey bi my gud frend.

10 Mak una grit Apelles for mi, bikos Jisos Kraist don shuz am. Den mak una stil grit Aristobulus famili for mi.

11 Mak una grit Herodion my kontriman and Narcissus and en famili wey don biliv God.

12 Grit Tryfana and Tryfosa, wey dey du Kraist wok.

13 Grit Rufus, di pesin wey di Oga don shuz and en mama wey trit mi laik sey e bi my mama.

14 Mak una grit Asynkritus, Flegon, Hermes, Patrobas, Hermas and all di brodas and sistas wey dey wit dem.

15 Grit Filologus and Julia, Nereus and en sista, Olympas and all di bilivas wey dey wit dem.

16 Mak una salot won anoda wit kiss for jaw. All di shosh wey bi Kraist own, dey grit una.

17 Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, mak una no di pipol wey dey kause wahala and opoz di tishin wey una don learn from us. Den mak una nor go near dem!

18 Bikos dis kaind pipol nor dey serv awa Oga Jisos Kraist, bot na dia bele dem dey kare for. Wit dia swit and wayo mout, dem go praiz and disiv pipol wey nor wise.

19 I dey hapi, bikos evribodi don no haw una dey obey God. Bot I wont mak una dey wise wen e rish mata wey dey gud or bad. Mak una nor du eni bad tin.

20 And God wey dey giv peace, go soon distroi Satan for una. Mak awa Oga Jisos Kraist grace dey wit una.

21 Timoti, my co-woka; Lucius, Jason and Sosipater my kontriman, all of dem dey grit una.

22 Ivun mi, Tertius wey rite dis leta, dey grit una wit Kraist name.

23 Gaius, wey dey kare for mi and di shosh, dey grit una. Erastus wey bi di tawn treasura and awa broda Kwatus, dey grit una.

24 Mak awa Oga Jisos Kraist grace dey wit una!

25 Mak wi praiz God, bikos e don mak una strong tru dis Gud News wey I dey prish abaut en pikin, Jisos Kraist. For meni years naw, dem kip dis mesage for sikrit,

26 bot naw, dem don tok am at last. God wey nor dey die, komand en profets mak dem rite abaut di Gud News, so dat pipol for evriwer, go obey am and get fate.

27 Naw, bikos of Jisos Kraist, wi fit praiz di onli God wey dey wise foreva! Amen.

Open Bible reader