Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 13

1 Mak evribodi obey di pipol wey dey rule dem. Bikos na onli God dey giv autoriti and put pipol for pawa.

2 So enibodi wey dey disobey dia rula, dey disobey God and God go ponish am.

3 Bikos doz wey dey du gud, nor go get problem wit dia rulas, so dem nor nid to fear. Mak una jos du wetin dey gud and dem go praiz una.

4 Bikos all rulas na God savant and na dia duti to help yu. If yu du bad, den mak yu fear, bikos dis rulas get pawa to ponish yu. Dem bi God savants wey dey ponish doz wey du wrong tins.

5 Bot yu must obey di rulas, bikos yu no sey naim bi di rite tin to du, nor bi bikos God go ves for yu.

6 Yu must stil pay yor tax tu. Di rulas na God savants and na dia wok to kare for all dis mata.

7 Mak yu pay evritin wey yu dey hol; weda na tax, respet or onor.

8 Mak luv bi di onli tin wey yu dey hol! If yu luv odas, yu don du evritin wey di law tok.

9 Di law get difren-difren komand laik, "Nor komit adultri; nor kil pesin; nor tif; nor put eye for anoda man propati." All dis na jos won komand wey sey, "Mak pipol luv odas, jos as dem luv diasef."

10 lf yu luv pesin, yu nor go du-am bad. So, na luv bi di main tin wey di law dey tok abaut.

11 Since una no di taim wey wi dey naw, mak una dey bihav wel, bikos di taim don rish wen una go wak-up from slip. Una no sey di day wey God go giv us salvashon, don near wel-wel pas as e bi wen wi first biliv.

12 Nite don nearli finish and day go soon break. So mak wi stop to bihav laik pipol wey dey daknes and mak wi redi to waka for lite.

13 So mak wi dey bihav wel as pipol dey du for day taim. Nor go enihaw parti or drink tu mush, den kon dey bihav enihaw. Nor kworel or joj pipol.

14 Insted, mak una wear Jisos Kraist laik klot for bodi. Den wi nor go du di tins wey awa bodi won t.

Open Bible reader