Nigerian Pidgin Bible
Romans 12
1 My brodas and sistas, God dey gud. So I beg, as una dey alaif, mak una dey offa una bodi giv am as sakrifais. Mak una dey du wetin E tok and wetin go mak bele swit am. Na dis bi di best way to serv God.
2 Mak una nor bi laik pipol for di wold, bot mak una alow God shange una maind, den una go no haw to serv God and du tins wey dey mak bele swit am.
3 By di grace wey God giv mi, I dey tel all of una, mak una nor tink sey una tu dey important. Insted, mak una yuz gud sense tink and undastand di fate wey God giv una.
4 Pesin bodi get difren parts and all di parts get dia own wok.
5 Na so e bi wit us. Wi meni, bot wi bi difren parts for Kraist bodi and wi bilong to ish oda.
6 Tru God grace, E don giv us difren-difren gift to yuz. If wi dey profesai, mak wi du-am akordin to di fate wey wi get.
7 If wi dey serv odas, mak wi serv dem wel. If wi dey tish, mak wi tish wel.
8 If wi dey prish, mak wi prish wel. If wi dey giv, mak wi du-am wit beta maind. If wi dey lid odas, mak wi du awa best. If wi dey du gud to odas, mak wi du-am wit hapines.
9 Mak wi luv ish oda wel-wel. Mak una hate enitin wey dey bad, bot una must luv enitin wey get trut.
10 Mak una luv ish oda laik brodas and sistas and mak una respet oda pipol pas unasef.
11 Mak una nor taya, bot wit di Holi Spirit help, mak una serv God wit beta maind.
12 Mak una let una hope giv una hapines. Mak una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.
13 Mak una giv fud to God pipol wey dey hungri and mak una dey welkom dem for una haus.
14 Mak una nor kos pipol wey dey opres una, bot mak una pray mak God bless dem.
15 Wen pipol dey hapi, mak una folo dem hapi and wen dem dey krai, mak una folo dem krai tu.
16 Mak una trai to bi frend wit evribodi. Mak una nor kari bodi up kon feel sey una wise pas evribodi, insted, mak una dey mak frend wit doz wey nor dey important.
17 Mak una nor pay evil for evil, bot mak sure sey wetin una dey du, gud for God and pipol eye18and mak una trai to liv for peace wit evribodi.
19 Mak una nor trai to pay enibodi for di bad tin wey dem du una, bot mak una liv am for God, bikos God wod sey, "Na mi go revenge for una. I go pay dem bak."
20 God wod stil sey, "If yor enemi dey hungri, mak yu gi-am fud chop, if en trot dry, mak yu gi-am wota drink, bikos as yu dey du so, na wahala yu dey kari put for en head."
21 So, mak una nor let bad tins kontrol una, bot mak una let di gud tins wey una dey du, plenti pas wikednes.