Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 1

1 Pol wey bi Jisos savant and apostol wey e shuz mak e prish God wod, na en rite dis leta.

2 Na dis gospol God promis us for en Holi Book tru en profets sey,

3 my Pikin kom dis wold from David famili

4 and naim bi my onli Pikin wey I wak-up from deat wit di Holi Spirit pawa.

5 Na tru am, God giv us favor and pawa to bi apostols and na dis pawa wi dey yuz tak dey kol Gentai pipol, mak dem obey and biliv en name.

6 Unasef dey among di pipol wey God kol to bi Jisos Kraist own.

7 Rome pipol wey God luv and kol mak dem bi en own, na una I dey rite dis leta giv. Mak God awa Papa for hevun and Jisos awa Oga giv una grace and peace.

8 Today, I tank my God tru en pikin Jisos Kraist for all of una, bikos na for di hol wold dem dey tok abaut haw una fate for God strong rish.

9 God wey I dey serv and prish en pikin gospol, na-im fit bear mi witnes sey I dey always rimemba una

10 and I always dey pray dey ask God if E go let mi kom si una again.

11 Bikos I dey hungri to si una, so dat I go giv una di Holi Spirit blessin wey go mak una strong,

12 so dat mi and una go dey hapi and Jisos Kraist wey wi biliv, go giv us res for awa maind.

13 My brodas and sistas, I wont mak una no sey I don plan to kom visit una meni taims, bot God nor let mi kom ontil naw. Bikos I won gain from una fate as I don du wit Gentai pipol.

14 Bikos God sey mak I prish to evribodi, weda na Greek or Gentai pipol or weda dem wise or foolish.

15 Na dis mak mi won kom prish God wod giv una wey dey Rome.

16 I nor dey shame to prish God wod, bikos na-im bi di pawa wey God tak dey save doz wey biliv am, weda dem bi Ju or Gentai pipol.

17 Bikos na di Gospol dey show haw God dey tak mak pipol klin for en eye. From di biginin go rish di end, God sey, "Na onli fate go mak pesin dey klin for my eye."

18 Bikos of all di sins and bad tins wey wiked pipol dey du, God vesnashon dey show from hevun and di sins dey kova di trut.

19 So God kon ponish dem, since dem no evritin wey dem sopoz to no abaut God, bikos na-im show dem.

20 From di taim wen God kreate di wold, E don show us di tins wey odinari eye nor dey fit si; en pawa and life, tru di tins wey E kreate. So wiked pipol nor get eskuze at-all.

21 Ivun doh dem no sey God dey, dem nor dey gri gi-am glori as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey du. Insted, na nonsense tins dem dey du and dia wiked maind nor fit undastand di trut again.

22 Ivun doh dem tink sey dem wise, dem bi fools;

23 bikos insted mak dem woship God wey dey hevun, dem kon dey woship image wey dem mold or karve laik pesin, bird, anima or snake.

24 So God don liv wiked pipol mak dem dey du di bad tins wey dia maind, wey bi sey man dey slip wit man and wuman dey slip wit wuman.

25 Dem don turn di trut abaut God to lai. Dem dey woship di tins wey E kreate, insted for dem to serv God wey deserv all di praiz foreva! Amen.

26 Bikos of dis, God liv dem for dia yeye life. Ivun di wimen shange and dem kon dey du tins wey nor gud.

27 And na so tu, men nor kon laik wimen again, bot dem kon dey laik to slip wit oda men. So, God kon ponish dem bikos of wetin dem dey du.

28 Since dem nor gri put God for maind and serv am, E kon liv dem mak dem yuz dia bad maind dey du tins wey dem nor sopoz du.~

29 Wetin ful dia maind na wikednes, evil tins, long-trot, bad bele, bad-bad tins; jelosi, to kil and fite, to lai, to kip enemi wit pipol, to joj pipol waka,

30 to tok bad abaut odas and hate God. Dem dey kari bodi up, dem nor get respet and na bad tins ful dia maind. Dem nor dey respet dia papa and mama.

31 Dem nor get sense, dem dey promis and fail, dem nor dey du gud or sori for pipol.

32 Aldoh dem no sey God law sey, pipol wey dey liv laik dat go die, yet dem nor onli dey du dis tins, bot dem ivun dey sopot pipol wey du-am.

Open Bible reader