Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 20

1 “God Kindom bi laik wen pesin komot for earli mornin go hire pipol wey go wok for en farm.

2 “Afta en and di wokas don agri haw mush dem go get for dia wok, e kon send dem go wok for en farm.

3 “Wen nain o' klok rish for mornin, e kon si pipol wey nor get wok stand for market.

4 “E kon tel dem, 'Mak una go wok for my farm, I go pay una wel.'

5 “So dem kon go. Wen e go out around twef and tiri o' klok for aftanun, e stil tel oda pipol mak dem go wok for di farm.

6 “Wen faiv o' klok for evenin don nearli rish, e si som pipol wey nor get wok and e kon ask dem, 'Why una nor dey wok and today don nearli finish?'

7 “Dem ansa am, 'Na bikos nobodi hire us.' E kon tel dem, 'Mak una enta my farm go wok.'

8 “Wen evenin rish, di owna of di farm tel en managa, 'Kol di wokas mak yu pay dem, start from di last pipol wey I hire.

9 “Pipol wey dem hire for faiv o' klok, kolet ful day salari.

10 “And wen di pipol wey dem first hire kom, dem tink sey di oga go pay dem pas laik dat. Bot dem get di same amount.

11 Wen di first pipol kolet dia moni, dem bigin komplain to di farm owna,

12' Dis last pipol wok for onli won hour and wi wok for di hol day insaid hot sun, bot yu pay all of us di same amount.'

13 “Di farm owna kon ansa won of dem, 'My frend, I nor du yu bad. Nor bi wetin wi agri, dem pay yu?'

14' Mak yu tak yor moni dey go. I laik giv dis last pipol di same amount wey I giv yu.

15' I nor fit yuz wetin bi my own as I laik? Or yu dey jelos bikos I dey du gud tin?'

16 “So, di pesin wey bi last, go bi first and di first, go bi last. “

17 As Jisos dey go Jerusalem, e tak en twef disaipols go won kona kon tok to dem.

18 “Mak una luk, wi dey go Jerusalem and dem go sel Man Pikin giv di prist oga dem and di law tishas. Dem go sey mak dem kil-am

19 and dem go gi-am to Gentai pipol mak dem laff and flog am wel-wel, den dem go nail am for kros. Bot for di ted day, God go wak-am up. “

20 Den Zebedi wife wit en shildren- James and Jon kom mit Jisos. Dia mama kon nil dan dey beg Jisos.

21 Jisos kon ask am, "Wetin yu wont? “Di wuman ansa, "Mak yu alow dis my tu boys sidan for yor kindom, won for yor rite side and di oda for yor left. “

22 Jisos ask dem again, "Una no wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I won drink from? “Dem ansa am, "Wi go fit. “

23 Jisos kon tel dem, "Na tru sey una go fit drink from my cup, bot e nor dey my hand to shuz hu go sidan for my rite and left. Bot na pipol wey my Papa don shuz. “

24 So wen di oda ten disaipols hear dis mata, dem kon dey ves wit di tu brodas.

25 Bot Jisos kon kol and tel dem, "Una no sey Gentai pipol oga and pipol for big posishon dey kontrol and opres dia pipol.

26 “Mak e nor bi laik dat among una! Insted, enibodi wey won bi oga among una, must serv di res pipol

27 and enibodi wey wont bi first among una, must bi savant to di odas,

28 jos as Man Pikin nor kom mak pipol serv am, bot mak e for serv and giv en life to save meni pipol. “

29 As Jisos dey komot from Jeriko, meni pipol kon dey folo dem.

30 Tu men wey blind sidan for di road kona. Wen dem hear sey Jisos dey pas, dem kon bigin shaut, "David Pikin, mak yu sori for us! “

31 Pipol kon dey shaut for dem mak dem kwayet. Bot dem kon dey shaut more-more, "David Pikin, mak yu sori for us. “

32 Jisos kon stop, kol and ask dem, "Wetin una wont mak I du for una? “

33 Dem ansa, "Oga, mak awa eye opun again. “

34 Jisos sori for dem, so e tosh dia eye. At wons, dem bigin si and dem kon folo Jisos.

Open Bible reader