Nigerian Pidgin Bible
Matthew 17
1 Afta sis days, Jisos tak Pita, James and Jon (wey bi James broda), go on-top won high mountin.
2 Jisos bodi kon shange. En face kon dey shine laik sun and en dress kon white.
3 At wons Mosis and Elija kon apier dey tok to Jisos.
4 So Pita kon tel Jisos, "Oga, e gud mak wi stay here. If yu laik, I go build tiri canopi- won for yu, won for Mosis and won for Elija.
5 As e stil dey tok, won brite kloud kon kova dem and won vois kon sey, "Dis na my Pikin wey I luv. Mak una listin to am!
6 Wen di disaipols hear di vois, dem fear kon fal face groun.
7 Bot Jisos tosh dem kon sey, "Stand up! Mak una nor fear.
8 Wen dem luk up, di onli pesin wey dem si, na Jisos.
9 As dem dey kom dan from di mountin, Jisos warn dem sey, "Mak una nor tel enibodi dis vishon wey una si ontil God go wak Man Pikin from deat.
10 Di disaipols kon ask am, "Why di law tishas dey tish sey na Elija go first kom?
11 Jisos ansa, "Na tru sey Elija go first kom and e go ripair evritin.
12 And I tel una sey, dat Elija don kom, bot pipol nor no am, insted dem du-am as dem laik. Na so tu, God Pikin go sofa for dia hand.
13 Den di disaipols kon no sey e dey tel dem abaut Jon di Baptist.
14 Wen Jisos and en disaipols mit di pipol, won man kon nil dan for Jisos front
15 beg am sey, "Oga, mak yu sori for my son, bikos siknes dey sofa am and meni taims, di siknes dey trow-am insaid fire and wota.
16 I bring am kom mit yor disaipols, bot dem nor fit heal am.
17 Jisos kon ansa, "Una wey nor get fate and wey nor no wetin to du! Haw long I go dey wit una? Haw long I go bear wit una? Mak una bring di boy kom here.
18 Den Jisos komand di dimon komot from di boy bodi and at wons, di boy kon wel.
19 Wen onli di disaipols dey wit Jisos, dem kon ask am, "Why wi nor fit driv di dimon komot from di boy bodi?
20 Jisos ansa dem, "Na bikos una fate tu smol and I tel una tru wod, 'If una get fate wey smol laik mustard sid, una go tel dis mountin, "Mak yu move from here go yonda and e go move and nortin go hard una to du.
21 Dis kaind dimon nor go gri komot from pesin bodi esept wit fastin and praya.'
22 Wen dem enta Galili, Jisos kon tel dem, "Sombodi go sel Man Pikin giv wiked pipol.
23 Dem go kil-am and for di ted day, God go wak-am up. Bot di disaipols nor hapi, bikos of wetin Jisos tok.
24 Wen Jisos and en disaipols rish Kapanum, di pipol wey dey kolet tax for di Tempol kom mit Pita, kon ask am, "Yor oga dey pay Tempol tax?
25 Pita ansa, "Yes. As Pita enta di haus, Jisos kon ask am, "Wetin yu tink, Saimon? Hu dey pay tax giv kings for dis wold? Na pipol for di kontri or strenjas?
26 Pita ansa, "Na strenjas dey pay tax. So Jisos kon tel am, "Den dia own kontri pipol dey fri.
27 Bot, mak dem nor for kause trobol, go trow hook for riva. Tak di first fish wey yu go kash, wen yu opun en mout, yu go si moni for insaid. Tak di moni pay di tax for mi and una."