Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 12

1 Dat taim, Jisos kon waka pas won corn farm for Sabat Day. En disaipols kon dey plok di corn chop, bikos dem dey hungri.

2 Bot wen di Farisi pipol si dem, dem kon tel Jisos, "Si, yor disaipols dey break di law for Sabat Day. “

3 Jisos kon ansa, "Una neva read wetin David du wen en and en pipol dey hungri,

4 haw dem enta God haus kon chop di holi bread wey ordinari pipol nor sopoz chop, bikos na onli prists sopoz to chop am?

5 “Or una neva read for Mosis law sey, prists dey wok for Sabat Day, bot nobodi dey sey dem komit sin?

6 “I tel una, pesin wey big pas di Tempol dey here wit una naw.

7 “If to sey una no wetin dis tin min: 'Na mesi I wont, nor bi sakrifais', una nor for kondem pesin wey nor komit sin.

8 “Man Pikin na-im bi di Oga for Sabat Day. “

9 Den Jisos komot der, kon enta dia sinagog.

10 Won man wey en hand die dey der. Som pipol wey dey faind as dem go tak akiuz Jisos kon ask, "E dey rite to heal for Sabat Day? “

11 Jisos ansa, "If eni of una get ship wey fal insaid pit for Sabat Day, en nor go-go kari am out?

12 “Humanbin beta pas ship! So, e dey rite to du gud for Sabat Day. “

13 Den Jisos tel di man, "Stresh yor hand. “Naim di man stresh en hand and di hand kon strong laik di oda won.

14 Bot di Farisi pipol kon go plan as dem go tak kil Jisos.

15 Wen Jisos hear sey dem dey plan to kil-am, e kon komot from der. Meni pipol folo am and e kon heal all of dem wey nor wel.

16 Bot e warn dem sey, mak dem nor tel enibodi hu e bi.

17 Dis mak wetin Profet Isaia tok, hapun:

18 “Na my Savant wey I shuz bi dis, di Won wey I luv, wey I dey hapi wit. I go put my spirit insaid am and e go joj di wold.

19 “E nor go kworel or shaut, nobodi go hear en vois for publik, e nor go tosh pesin wey wik,

20 or kwensh di smol hope wey pesin get, ontil dem go stop to opres pipol.

21 “And en name go giv hope to Gentai and oda pipol for dis wold. “

22 So dem kon bring won blind man wey get dimon and nor fit tok kom mit Jisos. Jisos heal am and di man kon dey si and tok.

23 Di pipol sopraiz wel-wel kon dey ask, "Dis nor bi David pikin wey wi dey wait for? “

24 Bot wen di Farisi pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, "Na Belzibub (wey bi dimon oga) pawa e dey yuz tak driv dimons komot from pipol bodi. “

25 Wen Jisos no wetin dem dey tink for dia maind, e kon sey, "Evri kindom wey dey fite wit ensef go skata and no tawn or famili wey dey fite demsef, go fit stand.

26 “So if Satan dey driv Satan komot, e don divide ensef bi dat. Haw en kindom go fit stand?

27 “And if na Belzibub pawa I dey tak driv dimons komot, na wish pawa una shildren dey tak driv dimon tu? Bikos of dis, una shidren go joj una.

28 “Bot if na God Spirit I tak dey driv dimons, naim bi sey God Kindom don alredi kom mit una.

29 “Haw pesin go fit break enta strong man haus kon tif en propati, unles e first tie di strong man? Den e go get shanse tif wetin dey di haus.

30 “Enibodi wey nor dey wit mi, dey against mi and enibodi wey nor join mi, dey skata my wok.

31 “Naim mak mi dey tel una sey, 'God go forgiv pipol dia sin and all di bad wod wey dem tok, bot enibodi wey kos or tok bad wod against di Holi Spirit, God nor go forgiv am.'

32 “Enibodi wey tok bad against Man Pikin, God fit forgiv am. Bot enibodi wey tok bad against di Holi Spirit, God nor go eva forgiv am, weda for dis life or di won wey dey kom. “

33 “Gud tri dey bear gud frut and bad tri dey bear bad frut. Na di frut wey tri bear, naim pipol tak dey no di kaind tri wey e bi.

34 “Una, snake shildren! Haw una won tak tok gud wod, since una wiked? Na wetin ful pesin heart, naim en mout go tok.

35 “As gud pesin dey bring gud tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart tu.

36 “I tel una tru wod, for jojment day, pipol go ansa God for all di yeye wod wey dem tok.

37 “Na di wod wey yu dey tok, naim go fit fri or kondem yu for God front. “

38 Some of dem wey bi law tisha and Farisi pipol kon tel Jisos, "Tisha, wi wont mak yu show us sign. “

39 Jisos ansa, "Si dis bad and wiked pipol for dis taim wey dey ask for sign, I nor go show una eni sign, esept Profet Jona own.

40 “As Jona dey insaid big fish bele for tiri days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for tiri days and nites tu.

41 “For jojment day, Nineve pipol go kondem di pipol for dis taim, bikos wen Jona prish giv dem, dem turn from sin kom mit God. And naw, sombodi wey big pas Jona dey here wit una!

42 “For jojment day, Sheba queen go kondem di pipol for dis taim, bikos e travol from far place kom hear Solomon wisdom. And naw, sombodi wey big pas Solomon dey here wit una! “

43 “Wen evil spirit don komot from pesin bodi, e dey pas wer wota nor dey, dey faind wer e go res, bot if e nor si,

44 e go tel ensef, 'I go-go bak to di haus wer I from komot.' Wen e go bak kon si sey di haus empti and dem don swip and arange am,

45 e go-go bring sevun spirit wey wiked pas am, kom. Dem go enta di pesin kon sidan for der, so di pesin kondishon go kon bad pas as e bi bifor. Na laik dis e go hapun to evil pipol for dis taim. “

46 As Jisos stil dey tok, en mama and brodas kon stand for outsaid, bikos dem won si-am.

47 So sombodi for der kon tel Jisos, "Si, yor mama and brodas dey outsaid bikos dem won tok to yu. “

48 Jisos kon ask di pesin, "Hu bi my mama and brodas? “

49 Den Jisos point to en disaipols kon sey, "Si, na dis pipol bi my mama and brodas.

50 “Pesin wey du wetin my Papa for hevun wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama."

Open Bible reader