Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 11

1 Wen Jisos don tish en disaipols finish, e kon komot from der go tish and prish for difren tawns for Galili.

2 Naw, wen Jon hear for insaid prizin abaut di tins wey Jisos dey du, e kon send en disaipols go ask am:

3 Na yu bi di Mesaya wey wi dey espet or mak wi wait for anoda pesin? �

4 Jisos kon ansa dem, "Mak una go tel Jon wetin una dey hear and si.

5 Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey kior lepa, deaf pipol dey hear, pipol wey don die dey wak-up and poor pipol dey hear di Gud News.

6 God go bless di pesin wey nor dey ves for mi. �

7 As Jon disaipols dey go, Jisos kon tel di pipol abaut Jon: "Wetin una go desert go si? Na seeds wey briz dey blow?

8 Hu una go outsaid go si? Abi na man wey wear fine dress? Pipol wey dey wear fine dress laik dat, nor bi king palise dem dey stay?

9 Wetin una go si for outsaid? Na profet? Yes! I tel una, e ivun big pas profet.

10 Na Jon bi di pesin wey dem rite for God wod abaut sey: 'Si, I dey send pesin go yor front, mak e go priper di way for yu.'

11 I tel una tru wod, among all di pipol wey wuman born, e nor get enibodi wey big rish Jon di Baptist. Bot di pesin wey smol pas for God Kindom, big pas am.

12 From Jon di Baptist taim kon rish naw, pipol dey strogol to enta God Kindom, bot na onli doz wey dey strogol wel-wel, dey fit enta.

13 Bifor Jon kom, Mosis law and di profets dey prish abaut wetin go hapun.

14 And if una gri wit wetin I dey tok, Jon, na-im bi Elija wey sopoz to kom.

15 Enibodi wey get ear, mak e hear!

16 Wetin I go sey dis taim pipol bi laik? Dem bi laik shildren for market wey dey hala for ish oda sey,

17' Wi blow flute for una, bot una nor gri dance, wi dey krai for awa pesin wey die, bot una nor folo us krai.'

18 Wen Jon di Baptist kom, e nor chop, drink or enjoy life bot una sey, 'E get dimon!'

19 Bot wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, 'Si-am, long-trot, drunkaman, tax koletors and sinas frend!' Bot God wisdom dey show by wetin e dey du. �

20 Jisos kon dey kos all di tawn wer e for du meni mirakols, bikos di pipol nor gri turn from sin kom mit God.

21 E nor go beta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakols wey dem du among una hapun for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom mit God, kon kari ashes put for head and wear tear-tear klot,

22 bot I tel una tru wod, e go eazi for Tyre and Sidon for jojment day pas una.

23 Una wey bi Kapanum pipol, una feel sey una fit kari unasef go hevun? No! God go trow una for hell fire, bikos if to sey dem du di mirakols wey dem du for una, for insaid Sodom, di tawn for stil dey til today.

24 Bot I tel una, God go get mesi for Sodom pas una for jojment day! �

25 For dat taim, Jisos kon sey, "I praiz yu Papa, Oga wey get hevun and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey no book wel-wel, bot yu show dem to smol shildren.

26 Yes! Papa, na so yu wont mak e bi.

27 My Papa put evritin for my hand. Nobodi no di pikin, bot na onli en Papa no-am. Nobodi no di Papa, bot na onli di pikin and enibodi wey di pikin shuz to show.

28 Una wey don taya and kari heavi load, mak una kom mit mi and I go giv una res.

29 Mak una folo mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey kari bodi up and I go giv una peace for una maind.

30 My way eazi to folo and my load nor heavi to kari."

Open Bible reader