Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Mark 16

1 Wen Sabat Day don pas, Mary Magdalene, Mary wey bi James and Salome mama kon buy spices wey dey sent wel-wel, mak dem go rub am for Jisos bodi, mak e nor for smel.

2 For earli mornin on Sunday, as sun jos dey kom out, dem kon go di place wey dem bere Jisos put.

3 Dem kon dey ask ish oda as dem dey go sey, "Hu go help us rol di stone komot from di grave mout?"

4 Bot wen dem luk, dem si sey, dem don alredi rol di stone komot.

5 As dem enta, dem si won man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon kash dem.

6 Bot e tel dem, "Mak una nor fear. Una dey faind Jisos wey kom from Nazaret, wey dem kil. God don raiz-am from deat! E nor dey here again. Mak una luk di place wey dem put am bifor.

7 "Mak una go tel en disaipols and Pita sey, Jisos don go Galili go wait for dem. Una go si-am for der, as e tel una bifor."

8 Dem kom out kon run from di grave side, bikos dem sopraiz and fear kon kash dem. Dem nor fit tel enibodi enitin, bikos dem stil dey fear.

9 [For earli mornin on Sunday, afta Jisos don wak-up, e first apier to Mary Magdalene wey e driv sevun dimon komot for en bodi.

10 For wer di pipol wey dey folo Jisos dey mourn and krai dey, Mary Magdalene kon go tel dem wetin hapun.

11 Wen dem hear sey Jisos don wak-up from deat and Mary Magdalene don si-am, dem nor biliv.

12 Afta, Jisos stil apier to tu pipol as dem dey waka go tawn.

13 Dem go bak go tel di res pipol, bot di pipol nor stil biliv dem.

14 Den Jisos kon apier to di ilevun disaipols wen dem dey chop. E kon shaut giv dem, since dem nor biliv, bikos of dia strong heart.

15 Jisos komand dem sey, "Mak una enta evriwer for di wold go prish di gospol giv evribodi.

16 "Enibodi wey biliv and dem baptize am, God go save am, bot enibodi wey nor biliv, God go kondem am.

17 "Dis signs go folo pipol wey biliv: Wit my name, dem go driv dimon komot from pipol bodi; dem go speak new language wey dem nor learn;

18 dem go fit hol snake and if dem drink poison, e nor go du dem enitin; dem go put dia hand for sik pipol bodi and di pipol go wel."

19 Afta Jisos don tok to dem finish, God kon kari am go hevun and e kon sidan for God rite side.

20 Den, di disaipols kon go evriwer for di aria dey prish di gospol and Jisos kon dey du meni mirakols tru dem, so dat pipol go no sey, wetin dem dey prish, na tru.]

Open Bible reader