Nigerian Pidgin Bible
Mark 1
1 Na so di gospol abaut Jisos Kraist, God Pikin tak start.
2 As Profet Isaia tok for di book wey e rite, "I dey send my mesenja for front, go priper di way for yu."
3 Won pesin dey shaut insaid desert sey, "Mak una priper Oga way for am, mak una mak en road strate."
4 For insaid desert, Jon di Baptist kon bigin prish sey, mak pipol liv di bad tins wey dem dey du, mak e for baptaiz dem, so dat God go forgiv dem dia sins.
5 Pipol for Judea and all di aria wey near am and doz wey dey Jerusalem, dey go mit Jon and e kon baptaiz dem for Jordan Riva afta dem konfes dia sins.
6 Jon wear klot wey dem tak kamel hair mak, tie leda belt for waist and e dey chop lokust and honi for insaid bush.
7 E kon sey, "Pesin wey big pas mi dey kom for my bak and I nor big rish hu go luz di rope wey dey en shu.
8 "I dey yuz wota baptaiz una, bot e go baptaiz una wit di Holi Spirit."
9 Dat taim, Jisos kom from Nazaret wey dey for Galili and Jon kon baptaiz am for Jordan Riva.
10 As Jisos dey kom out from di wota, hevun opun and God Spirit kom dan laik dove kon land for en head.
11 Den won vois tok from hevun sey, "Yu bi My Pikin wey I luv and yu dey mak bele swit Mi wel-wel."
12 At wons, God Spirit kon tak am go insaid di desert.
13 E stay insaid di desert wer Satan tempt am for forti days. E dey der wit wiked animas and God angels kon gi-am evritin wey e wont.
14 Afta dem don put Jon for prizin, Jisos kon enta Galili dey prish di Gud News sey,
15 "Di taim wey God promis sey en kindom go kom don rish. So mak una liv di sins wey una dey du kon biliv di Gud News."
16 As Jisos dey waka for Galili wotasaid, e kon si Saimon and en broda Andru wey dey trow net insaid riva, (bikos dem bi fishamen.)
17 Jisos kon tel dem, "Mak una folo mi and I go giv una pawa to kash pipol."
18 At wons, dem liv dia net kon folo Jisos.
19 As dem waka go front smol, dem si James and Jon, wey bi Zebedi shildren insaid boat dey ripair dia net.
20 At wons, Jisos kol dem, so dem liv dia papa, Zebedi, wit di men wey dem haya for insaid di boat, kon folo Jisos.
21 Jisos wit en disaipols kon go Kapanum. Wen Sabat Day rish, Jisos kon enta di sinagog bigin tish.
22 Di pipol sopraiz, bikos e sabi tish pas di law tishas.
23 For insaid di sinagog, won man wey evil spirit dey insaid en bodi kon shaut dey sey,~
24 "Mak yu liv us o-o, Jisos wey kom from Nazaret! Abi, yu don kom distroi us? I no hu yu bi. Yu bi God Pikin wey dey holi."
25 Bot Jisos komand am, "Shut up and kom out from di man!"
26 Afta di evil spirit don shake di man wel-wel, e shaut kon kom out from di man bodi.
27 Evribodi sopraiz dey ask ish oda, "Wish won bi dis? Dis new tishin strong o-o! Ivun wiked spirit dey obey en komand."
28 So, di stori abaut wetin Jisos dey du kon spread kwik-kwik for evriwer for Galili.
29 As Jisos, James and Jon komot from di sinagog, dem kon enta Saimon and Andru haus.
30 Saimon wife mama nor wel, so dem kon tel Jisos abaut am.
31 Jisos go mit am, hol en hand and di wuman kon stand-up. Den di fiva komot from en bodi and e kon dey serv dem.
32 Wen sun don dey go dan for evenin, dem kon bring all di pipol wey nor wel and wey get dimon kom mit Jisos.
33 Di hol tawn kon gada for di domot.
34 So, Jisos heal meni pipol wey nor wel wit difren-difren diziz and e driv meni dimon komot from pipol bodi. Bot e nor let di dimons tok, bikos dem no hu e bi.
35 For earli mornin wen evriwer stil dak, Jisos kon liv di haus go won kwayet place go pray.
36 Saimon and di pipol wey dey wit am kon dey faind am.
37 Wen dem si-am, dem kon sey, "Evribodi dey faind yu."
38 Jisos tel dem, "Mak wi go anoda vilage, so dat I go prish for der tu. Bikos na wetin I kom du, bi dat."
39 So e kon go evriwer for Galili dey prish for dia sinagog and dey driv dimon komot from pipol bodi.
40 Won man wey bi lepa kom mit Jisos, nil dan for en front dey beg am sey, "If yu wont, yu go fit mak mi wel."
41 Jisos sori for di man, so e tosh am kon sey, "I wont, so mak yu wel!"
42 At wons, di leprosi komot from di man bodi and e kon dey okay.
43 So Jisos warn di man wel-wel as e dey go sey,
44 "Mak yu nor tel enibodi abaut wetin hapun so, bot go show yorsef to di prist. And mak evribodi for no sey yu don klin, mak yu tak di ofrin wey Mosis komand, folo bodi."
45 Bot as di man dey go, e kon bigin shaut for evriwer dey spread di stori, sotey Jisos nor fit enta eni tawn again, so e kon dey stay wer pipol nor dey. Bot pipol stil dey kom mit am from evriwer.