Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Malachi 3

1 God Almighty talk say,” I dey send my messenger make he go prepare way for me. Then God wey una dey look for go come to him Temple suddenly. Yes, the messenger wey una dey expect to tell una about my agreement dey come.

2 No one fit prepare for that time or stand against am when him come. He go be like burning fire. He go be like strong soap wey people dey use wash something clean.

3 He go make the Levite clean. He go makethdem pure, as fire dey made silver pure! Him go make dem pure like silver and gold. Dem go bring gifts to God and dem go do things in the right way.

4 And God go accept the gift from Judah and Jerusalem, as dem use to be in the past.

5 Almighty God talk say, I go bring una to justice. I go be an expert witness and I go testify about evil things wey people dey do. I speak out against those wey dey do evil magic or commit adultery. I speak against those wey dey make false promises and cheat their workers and no pay dem the money wey dem promise dem. I go testify against those wey no help strangers, or widows and orphans and I go testify against those wey no respect me.

6 I be God, and I no dey change. And una children of Jacob, una never destroy finish.

7 Una be like una ancestor before, una don turn away from my laws and no keep them. Make una turn back to me and I go turn back to una. And una ask, wetin we go do to turn back to you?’

8 I ask una, shey e dey right make person dey cheat God? No, but una dey cheat me. Una ask say, “How?” Na for tithe and offerings.

9 Curse dey on top all of una because all the nation dey cheat me.

10 Make una bring una complete tithe come Temple, so that plenty food go dey there. Put me for test and una go see say I go open the widow of heaven and pour on una abundance of good things.

11 I no go allow insect destroy una crops, and una grapevines go get plenty grapes.

12 And people of nations go call una happy, because una land go be good place to stay.

13 God talk say, una don say terrible things about me. And una ask, ’Wetin we don say about you?’

14 Una don talk say, na useless thing to dey serve God. Wetin be the use to dey do wetin he say or to dey tell Almighty God say we dey sorry for wetin we don do?

15 As we see am, na proud people dey always dey happy. Evil people no dey only dey happy, but dem dey always test God patience with evil wey dem dey do and nothing dey happen to them.

16 And those wey fear God dey talk to each other, and God dey listen and hear wetin dem say. A book dey for him front wey dem dey write the name of those wey fear God and respect am .

17 Almighty God talk say, “Dem go be my people,” And when I act, dem go be my own. I go dey merciful to them, as father dey always dey merciful to the son wey serve am.

18 And again my people go see the difference wey dey between wetin dey happen to righteous and the wicked. Una go learn the difference wey dey between the people wey dey serve me and the one wey no dey serve me.”

Open Bible reader