Nigerian Pidgin Bible
Luke 7
1 Afta Jisos tish di pipol all dis tins, e kon go Kapanum.
2 For der, won Roman soja get won savant wey e laik wel-wel, bot di savant nor wel and e nearli die.
3 Wen di soja hear abaut Jisos, e kon send som Ju eldas go mit am sey, mak e kom heal en savant.
4 Wen dem si Jisos, dem beg am wel-wel sey, "E gud mak yu kom help am,
5 bikos e luv awa pipol and e ivun build sinagog for us."
6 So Jisos folo dem go. As Jisos near di haus, di soja kon send som of en frends go mit am sey, "Oga, nor trobol yorsef, bikos I nor big rish hu yu go enta en haus.
7" Naim mak mi nor waka kom mit yu, insted, mak yu jos giv orda and my savant go wel.
8" Bikos mi tu get pipol wey big pas mi and I get di won wey I big pas. If I tel won, 'Go!' E go-go' and anoda won, 'Kom!' E go kom and if I tel my savant, "Do dis tin!' E go du-am."
9 Wen Jisos hear dis, e sopraiz and bele swit am, naim e luk di pipol wey dey folo am kon tel dem, "I tel una tru wod, I neva si dis kaind fate bifor, ivun for Izrel."
10 So, wen doz wey di soja send go bak to di haus, dem kon si sey di savant don wel.
11 Afta, Jisos go won tawn wey dem dey kol Nain, en disaipols wit meni pipol folo am.
12 Near di tawn gate, dem mit pipol dey kari won deadbodi go bere. Di man mama na widow and naim bi di wuman onli pikin, so plenti pipol from di tawn kon folo am.
13 Wen Jisos si di wuman, e sori for am kon tel am, "Mak yu nor krai again."
14 Den e waka go tosh di kofin and di men wey kari am kon stop. Jisos kon sey, "Young-man, get up!"
15 So di young-man get up kon start to dey tok. Jisos kon gi-am bak to en mama.
16 Fear kash all of dem and dem kon dey praiz God sey, "Na big profet kom mit us so-o!" and "God don kom help en pipol!"
17 Di news abaut Jisos kon spread roun Judea and all di place wey near der.
18 Jon disaipols kon tel Jon abaut di tins wey dey hapun. So e kol tu of en disaipols
19 kon send dem go ask Jisos sey, "Na yu bi di pesin wey wi dey espet, abi mak wi wait for anoda pesin?"
20 Wen dem si Jisos, dem kon sey, "Jon di Baptist send us mak wi ask sey, 'Na yu bi di pesin wey wi dey espet, abi mak wi wait for anoda pesin?'"
21 For dat same taim, Jisos heal meni pipol wey get difren siknes, pipol wey get evil spirit and pipol wey nor fit si, kon dey si.
22 So, Jisos ansa dem, mak una go tel Jon wetin una don si and hear: "Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka bifor, dey waka, pipol wey get leprosi, dia bodi don klin, pipol wey nor dey hear, don dey hear naw, pipol wey don die, don wak-up and ivun poor pipol, don hear di Gud News.
23 "God go bless pipol wey nor dey doubt mi."
24 Wen Jon mesenjas don go, Jisos kon bigin tok to di pipol abaut Jon: "Wetin una go faind for insaid desert? Na grass wey briz dey blow?
25 "Wetin una go out go si? Na man wey wear fine klot? No! Bikos pipol wey dey wear fine klot and dey enjoy life, na king palise dem dey stay.
26 "Wetin una go out go si? Na profet? Yes! I tel una, e ivun big pas profet.
27 "Dis na wetin dem rite abaut am, 'I dey send my mesenja go yor front, wey go-go priper yor road for yu.'
28 "I tel una tru wod, among all di pipol wey wuman born, nobodi big rish Jon di Baptist, bot di pesin wey smol pas for God Kindom, big pas am."
29 (Naw, evribodi wey hear dis tins, ivun di tax koletors, no sey God dey du wetin dey rite, bikos Jon di Baptist baptaiz dem.
30 Bot di Farisi pipol and di law tishas rejet wetin God plan for dem, bikos Jon nor baptaiz dem.)
31 "Haw I won tak tok abaut pipol wey dey for dis wold naw?
32 "Dem bi laik shildren wey sidan for market dey tel ish oda, 'Wi play musik for una, bot una nor gri dance; wi sing beria song for una, bot una nor gri krai.'
33 "Wen Jon di Baptist kom, e nor chop fud or drink wine, bot una sey, 'E get dimon!'
34 "God Pikin kom, dey chop and drink and una sey, 'Si-am, longtrot, drunkad, na tax koletors and sinas bi en frend.'
35 "Bot doz wey get wisdom, no sey evritin abaut am, na trut."
36 Won Farisi kon invait Jisos kom chop for en haus, so Jisos enta di Farisi haus kon sidan.
37 Den, wen won wuman from dat tawn wey bi sina hear sey Jisos dey chop for di Farisi haus, e kon bring won fine oil botol, wey dey sent wel-wel, kom.
38 E nil dan for Jisos front dey krai and e kon dey wet Jisos leg wit di tears from en eye. E klin Jisos leg wit en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.
39 Wen di Farisi wey invait Jisos si wetin dey hapun, e kon tok for en maind sey, "If dis man na profet tru-tru, e for no sey dis wuman wey dey tosh am so, na sina e bi."
40 Jisos kon tel di Farisi, "Saimon, e get wetin I won tel yu." Saimon kon sey, "Tisha, I dey listin."
41 "E get won man wey get tu savant wey dey hol am moni, won dey hol am faiv tazon and di oda won, faiv ondred.
42 "Wen tu of dem nor fit pay di moni bak, e kon sey mak dem forget abaut di moni. Afta dat, wish of dem go laik di man pas?"
43 Saimon ansa, "Na di won wey en moni big pas." Jisos kon tel am, "Wetin yu tok, koret."
44 Den Jisos luk di wuman kon ask Saimon, 'Yu dey si dis wuman? I enta yor haus, yu nor giv mi wota wosh leg, bot di wuman don wosh my leg wit en tears kon tak en hair klin am.
45 "Wen I enta yor haus, yu nor kiss or grit mi as awa tradishon bi, bot since I enta, dis wuman neva stop to kiss my leg.
46 "Yu nor pour oil for my head, bot dis wuman don anoint my leg wit oil wey dey sent wel-wel.
47 "Mak I tel yu, I don forgiv dis wuman en meni sins, so en luv don big wel-wel, bot di pesin wey dem forgiv smol sin, en luv go smol."
48 Den Jisos tel di wuman, "I forgiv yu all yor sins."
49 Bot di pipol wey sidan dey chop wit Jisos kon dey tel ish oda, "Hu bi dis man wey dey forgiv sin?"
50 So, Jisos tel di wuman, "Yor fate don save yu; mak peace folo yu go."