Nigerian Pidgin Bible
Luke 4
1 Di Holi Spirit enta Jisos bodi kon kari am from Jordan Riva go insaid widanes.
2 For der, devol kon tempt am for forti days. Dat taim, Jisos dey fast, so e nor chop fud, bot afta e fast finish, e kon dey hungri.
3 Devol kon tel am, "If na tru sey yu bi God Pikin, mak yu komand dis stone mak e turn to fud."
4 Den Jisos ansa, "God wod sey, 'Nor bi onli fud man sopoz to chop for dis wold, bot na evri wod wey God tok.'"
5 Den devol tak Jisos go on-top won mountin kon show am all di kindom wey dey dis wold.
6 den e tel am, "I go giv yu all dis place and all di onor wey folo am as yor kindom, bikos dem don giv am to mi and I fit gi-am to enibodi wey I wont.
7 "So, if yu bow dan woship mi, I go giv yu evritin."
8 Jisos ansa, "God wod sey, 'Na onli God yu must woship and serv.'"
9 Den devol tak Jisos go Jerusalem kon mak am stand on-top di place wer high pas for di Tempol kon tel am, "If yu rili bi God Pikin, mak yu jump go dan,
10 bikos God wod sey, 'God go tel en angels mak dem gaid yu'
11 and, 'Dem go kari yu for dia hand, so dat yu nor go yuz yor leg nak stone.'"
12 Jisos ansa am, "God wod sey, 'Mak yu nor test God wey bi yor Oga.'"
13 So wen devol don tempt Jisos finish, e kon liv am ontil anoda taim.
14 As di Holi Spirit pawa ful Jisos bodi, e kon go bak to Galili and en stori bigin spread for di hol aria.
15 E bigin tish for dia sinagog and evribodi kon dey praiz God.
16 Afta, Jisos go Nazaret wer e for grow up, e enta di sinagog for Sabat Day as e dey always du and e kon get up mak e read.
17 Dem gi-am di book wey Profet Isaia rite. Jisos kon opun am rish di place wey dem rite sey,
18 "God Spirit dey my bodi, bikos E don anoint mi mak I prish Gud News giv poor pipol. E send mi mak I prish fridom giv pipol wey dey prizin and mak blind pipol for si. E stil sey mak I fri doz wey dem dey opres
19 and mak I annouce sey di taim wen God won save en pipol, don rish."
20 Jisos klose di book kon gi-am bak to di pesin wey dey hol am, den e go sidan. So evribodi wey dey di sinagog kon dey luk am.
21 Den Jisos tel dem, "Today, di tins wey dem rite for God wod for wer I read, don hapun, jos as una hear am wen I dey read am."
22 Evribodi dey tok gud abaut Jisos, dem sopraiz for di swit-swit wod wey kom out from en mout. So dem kon ask, "Dis nor bi Josef pikin?"
23 Jisos tel dem, "I no sey una go kwote proverb for mi sey, 'Doktor, mak yu kior yorsef!' And una go sey, 'For here wey bi yor home-tawn, wi won mak yu du wetin wi hear sey yu du for Kapanum.'"
24 Jisos stil sey, "Mak I tel una tru wod, profet nor dey get respet for en home-tawn.
25 "Bot I tel una di trut, wimen wey dia husban don die meni for Izrel for Elija taim, wen God stop rain for tiri and haf years and beta hunga kon dey evriwer.
26 "Bot God nor send Elija go mit eni of doz wimen, esept won wuman wey en husban die for Zarepat insaid Sidon.
27 "Pipol wey get leprosi meni for Izrel for profet Elisha taim, bot God nor heal eni won esept Naaman, wey kom from Syria."
28 Wen dem hear dis tins, all di pipol for di sinagog kon dey ves.
29 Dem push Jisos komot from di tawn kon tak am go di hil wey dia tawn dey on-top, mak dem for trow am dan.
30 Bot Jisos pas dia senta, waka komot.
31 So Jisos kon go Kapanum, wey dey Galili and e bigin tish pipol for Sabat Day.
32 Dem sopraiz wel-wel for en tishin, bikos e dey tok wit autoriti.
33 Insaid di sinagog, won man wey evil spirit dey en bodi kon dey shaut,
34 "Abeg, mak yu liv us alone, Jisos wey kom from Nazaret! Yu don kom distroi us? I no hu yu bi, yu bi God savant wey holi."
35 Bot Jisos tel am: "Mak yu shut up! Yu dimon, komot for en bodi." Di dimon trow di man for groun for dia front kon komot for en bodi, bot di man nor wound.
36 Di pipol sopraiz kon dey ask ish oda, "Wetin dey hapun so? Dis man dey yuz God pawa tak komand dimon and dem dey obey am!"
37 So di news abaut Jisos kon spread enta di hol aria for Galili.
38 Afta Jisos komot for di sinagog, e enta Saimon haus. Saimon wife mama get fiva and dem kon beg Jisos make e heal am.
39 So Jisos stand near di wuman kon komand di fiva komot for en bodi. Kwik-kwik, di wuman get up, bigin kare for Jisos and di odas wey dey di haus.
40 As day dey dak, evribodi wey get pipol wey nor wel kon bring dem kom mit Jisos. E tosh dem for head and dem kon wel.
41 Dimons dey shaut dey komot from meni pipol bodi, dey sey, "Yu bi God Pikin!" Bot Jisos warn dem mak dem nor tok, bikos dem no sey, naim bi di Mezaya.
42 Wen day break, Jisos komot go won place wer nobodi dey. Bot pipol faind am rish der and dem kon dey trai to hol am mak e nor for liv dem.
43 Bot Jisos tel dem, "I must prish dis Gud News abaut God Kindom giv pipol wey dey oda tawns, bikos na wetin God send mi kom du, bi dat."
44 So e kontinu to prish for di sinagogs wey dey Judea.