Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 3

1 Tiberius Caesar don dey rule for fiftin years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galili, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene.

2 For dat taim, na Annas and Kaifas bi di High Prists. So God kon tok to Jon, wey bi Zekaraya pikin, for insaid desert.

3 Jon kon go all di aria wey dey roun Jordan Riva dey prish sey mak pipol turn from dia sin kom mit God and mak dem baptaiz, so dat God go forgiv dem.

4 As Profet Isaia tok for di book wey e rite sey, "Won vois dey shaut for insaid desert sey: 'Priper di way for di Oga and mak en road strate.

5 "Evri place wey low, God go mak am high and evri place wey high, God go mak am low, ben-ben road go strate, di road wey bad, go gud

6 and evribodi for dis wold go si God savashon.'"

7 So Jon tel di pipol wey kom mak e for baptaiz dem sey, "Una wey bi snake shildren! Hu warn una mak una run komot from God ponishment wey dey kom?

8 "Naw, mak una bear frut wey go show sey una don rili turn from sin kom mit God, mak una nor start to sey, 'Abraham na awa papa.' Bikos God fit tak dis stones wey dey for groun tak mak pikin for Abraham!

9 "Ivun naw sef, di axe don redi to kut di tri wey nor dey bear beta frut, dem go kut am dan kon trow am insaid fire."

10 So di pipol kon ask am, "Wetin wi go du naw?"

11 Jon ansa dem, "Di pesin wey get tu klot must giv won to pesin wey nor get at-all and di pesin wey get fud must share wit pesin wey nor get."

12 Tax koletors tu waka kom mak Jon for baptaiz dem and dem kon ask am, "Tisha, wetin wi go du?"

13 Jon tel dem, "Mak una nor kolet moni pas di won wey di law tok."

14 Den som sojas kon stil ask am, "Wot of us? Wetin wi go du?" E tel dem, "Mak una nor yuz fos kolet moni from enibodi hand or lai for enibodi head and mak una salari, rish una."

15 All di pipol kon dey wonda weda Jon, naim bi di Mezaya wey dem dey wait for.

16 Jon ansa dem, "Na ordinari wota I tak dey baptaiz una, bot di pesin wey big pas mi, dey kom, I nor rish hu go luz di rope wey dey en shu. E go baptaiz una wit di Holi Spirit and fire.

17 "E hol shovel for hand to havest di corn kip for en store, bot e go burn di corn kanda wit fire wey nor dey kwensh."

18 Na so Jon prish di Gud News for di pipol.

19 Bot wen Jon tel Herod wey bi govnor sey, God dey ves wit am, bikos of en broda wife, Herodias, wey e mari and all di bad-bad tins wey e du,

20 Herod tak all dis join di vesnashon wey e get for Jon, so e kon lock am for prizin.

21 So wen all di pipol don baptaiz, Jisos ensef kon baptaiz tu. Wen e dey pray, hevun opun,

22 di Holi Spirit kon kom dan for en head laik dove. Den won vois tok from hevun sey, "Yu bi my Pikin wey I luv wel-wel and yu dey mak bele swit mi."

23 Jisos start en ministri wen e bi tati years. Evribodi no am as Josef pikin, wey Heli born.

24 Heli na Mattat pikin, wey Levi born. Levi na Melchi pikin, wey bi Jannai pikin and na Josef bi Jannai papa.

25 Josef na Mattatias pikin wey bi Amos pikin, wey bi Nahum pikin, wey bi Esli pikin, wey bi Naggai pikin.

26 Naggai na Maat pikin, wey bi Mattatias pikin, wey bi Semein pikin, wey bi Josec pikin, wey bi Joda pikin.

27 Joda na Joanan pikin, wey bi Rhesa pikin, wey bi Zerubabel pikin, wey bi Shealtiel pikin, wey bi Neri pikin.

28 Neri na Melchi pikin, wey bi Addi pikin, wey bi Kosam pikin, wey bi Elmadam pikin, wey bi Er pikin.

29 Er na Joshua pikin, wey bi Eliezer pikin, wey bi Jorim pikin, wey bi Mattat pikin, wey bi Levi pikin.

30 Levi na Simeon pikin, wey bi Juda pikin, wey bi Josef pikin, wey bi Jonam pikin, wey Eliakim born.

31 Eliakim na Melea pikin, wey bi Menna pikin, wey bi Mattata pikin, wey bi Natan pikin, wey bi David pikin.

32 Jesse wey Obed born, naim bi David papa. Obed papa na Boaz, wey bi Salmon pikin, wey bi Nashon pikin.

33 Aminadab wey bi Admin pikin, naim born Nashon. Admin papa na Arni, wey bi Hezron pikin, wey bi Perez pikin wey Juda born.

34 Jakop wey Izik born, naim bi Juda papa. Abraham born Izik and na Tera wey Nahor born, bi Abraham papa.

35 Nahor na Serug pikin, wey bi Reu pikin, wey bi Peleg pikin, wey bi Eber pikin, wey bi Shela pikin.

36 Kainan wey Afazad born, naim bi Shela papa. Afazad na Shem pikin, and Noah wey Lamek born, naim bi Shem papa.

37 Lamek na Metusela pikin, wey bi Enok pikin, wey bi Jared pikin and Mahalalel wey Kenan born, naim bi Jared papa.

38 Kenan na Enos pikin, wey bi Set pikin, wey bi Adam pikin and na God kreate Adam.

Open Bible reader