Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 18

1 Den Jisos tel dem won parabol to show sey, e gud mak pipol dey always pray.

2 E sey, "Won joj dey for won tawn wey nor dey fear God and e nor dey respet enibodi.

3 "For dat tawn, e get won wuman wey en husban don die. E kon go mit di joj kon beg am, 'Mak yu help mi, bikos som pipol dey shit mi.'

4 "Di joj nor first listin to am, bot afta, e tok for en maind sey, 'Aldoh I nor dey fear God and respet enibodi,

5 bot bikos dis wuman dey disturb mi, I go mak sure sey e get wetin e sopoz get, oda-wise e nor go let mi res wit dis en beggi-beggi wey nor dey finish.'"

6 Jisos sey, "If di wiked joj tok laik dis,

7 una nor tink sey God go help en pipol wey dey krai to am for day and nite? Abi, God go wait tey bifor E help dem?

8 "I tel una tru wod, God go help dem kwik-kwik. Bot, wen Man Pikin kom bak, e go si pipol wey get fate?"

9 Jisos kon tel dis parabol to som pipol wey biliv and feel sey, na dem holi pas and nobodi gud rish dem.

10 "Tu men go insaid Tempol go pray. Won na Farisi and di oda won na tax koletor.

11 "Di Farisi kon stand dey pray abaut ensef sey: 'God, I tank yu sey I nor bi laik oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey komit adoltri or ivun laik dis tax koletor.

12 'I dey fast tu taims a wik and I dey pay won out of evri ten tins wey I get, giv Yu.'

13 "Bot di tax koletor stand for far place and e nor ivun luk hevun, bot kon nak en chest dey sey, 'God, mak yu sori for mi, bikos I bi sina!'

14 "I tel una tru wod, na di tax koletor God go forgiv, nor bi di Farisi. Bikos enibodi wey kari ensef go up, God go bring am dan, bot di pesin wey put ensef dan, God go kari am up."

15 Som pipol kon bring dia pikin mak Jisos tosh dem. Bot wen di disaipols si dem, dem kon bigin shaut for di pipol wey bring di shildren.

16 Bot Jisos kol di shildren kon sey, "Mak una alow di smol-smol shildren kom mit mi, nor stop dem, bikos na pipol laik dem get God Kindom.

17 "I tel una tru wod, enibodi wey nor risiv God Kindom laik smol pikin, nor go enta insaid."

18 Won day, won Ju oga ask Jisos, "Gud tisha, wetin I go du to get life wey nor dey end?"

19 Jisos kon tel am, "Why yu dey kol mi gud? Nobodi gud esept God.

20 "Yu no di komandment dem wey sey, 'Mak yu nor slip wit pesin wey nor bi yor husban or wife, nor kil pesin, nor tif, respet yor papa and mama.'"

21 Di man ansa Jisos, "I dey obey all dis law wit all my heart since I bi smol boy."

22 Wen Jisos hear wetin di man tok, e kon tel am, "E stil get won tin wey yu neva du, mak yu sel evritin wey yu get, giv di moni to poor pipol, den yu go get rishis for hevun. Afta dat, mak yu kom folo mi."

23 Wen di man hear dis won, e kon dey ves, bikos e rish wel-wel.

24 Wen Jisos no sey di man dey ves, e kon tel di pipol wey dey wit am, "E go hard wel-wel for pesin wey rish wel-wel to enta God Kindom!

25 E dey ezi for kamel to pas nido hol dan for pesin wey rish wel-wel to enta God Kindom."

26 Pipol wey hear dis wod kon sey, "Den hu God go save?"

27 Jisos ansa, "Wetin nor posibol for humanbin, dey posibol wit God."

28 Den Pita sey, "Oga, wi don liv evritin wey wi get kon folo yu!"

29 Jisos kon tel dem, "I tel una di trut, enibodi wey liv en haus, wife, brodas, papa, mama or pikin bikos of God Kindom,

30 God go bless am wit wetin pas all di tins wey e liv, both for dis wold and for di life wey dey kom."

31 Jisos kol di twef disaipols go kona kon tel dem, "Si, wi dey go Jerusalem and evritin wey di profets rite abaut Man Pikin go hapun for der.

32 "Bikos dem go gi-am to Gentai pipol and dem go laff, kos and spit for en bodi.

33 "Dem go flog am wel-wel and dem go kon kil-am. Bot for di ted day, e go wak-up."

34 Bot di twef disaipols nor undastand wetin Jisos tok, bikos God hide wetin e min from dem.

35 As Jisos near Jeriko, won man wey blind sidan for di road kona dey beg.

36 Wen e hear plenti pipol dey pas, e kon ask wetin dey hapun.

37 Dem kon tel am sey Jisos wey kom from Nazaret dey pas.

38 So di man kon dey shaut, "Jisos, David pikin, mak yu sori for mi -o-o!"

39 So di pipol wey dey en front kon dey shaut for am mak e kwayet, bot e kon dey shaut more-more, "David pikin, mak yu sori for mi -o-o!"

40 So Jisos stop kon sey mak dem bring di bega kom mit am. Wen di man kom, Jisos kon ask am,

41 "Wetin yu wont mak I du for yu?" Di man sey, "Oga, I won si again."

42 Jisos kon tel am, "Mak yu si naw, yor fate don heal yu."

43 At wons, di man bigin si and e kon folo Jisos, dey praiz God. Wen di pipol si wetin hapun, dem kon bigin praiz God.

Open Bible reader