Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 9

1 Wen Jisos dey waka pas, e kon si won man wey blind from di taim wey en mama born am.

2 Naim en disaipols ask am, "Tisha, na wish pesin sin, wey mak dis man blind since di taim en mama born am? Na di man or na en papa and mama?"

3 Jisos ansa dem, "Nor bi di man or en papa and mama sin, bot e blind since dem born am, bikos God won yuz dis won show en pawa wit wetin go hapun to am.

4 "I must du di wok for di Pesin wey send mi bifor day go dak, bikos nite dey kom wen nobodi go fit wok.

5 "As far as I dey insaid dis wold, na mi bi di lite for di wold.

6 Afta e tok finish, e spit for groun kon tak di san-san wey e spit put tak rub di blind man eye.

7 Den e tel am, "Mak yu go wosh yor face insaid di pond wey dem dey kol Siloam (dis name min 'Send'). So di blind man kon go wosh en face as Jisos tel am. As e dey kom bak, e kon bigin si.

8 Den en nebors and oda pipol wey dey si-am dey beg bifor, kon dey ask sey, "Dis nor bi di man wey dey sidan dey beg for moni?"

9 Som pipol ansa, "Na-im o-o!" Odas tok sey, "Nor bi en, bot e luk laik am." Di man ensef kon sey, "Na mi bi di pesin."

10 Dem ask am, "Wetin hapun wey mak yu bigin si?"

11 E kon ansa dem, "Na di man wey dem dey kol Jisos tak san-san wey e spit put rub my eye. Den e tel mi sey, 'Mak yu go Siloam go wosh yor face.' Afta I go wosh my face for di pond, I kon bigin si."'

12 Naim dem ask am, "Wer di man dey?" E kon ansa dem, "I nor no-o-o."

13 Dem kon tak di man wey blind bifor go mit di Farisi pipol.

14 (bikos na for Sabat Day Jisos spit for san-san tak rub di blind man eye).

15 Naim di Farisi pipol ask am again, "Haw yu tak bigin si?" E kon ansa dem, "E tak di san-san wey e spit put rub my eye and afta I don wosh my face, I kon bigin si."

16 Som Farisi pipol kon sey, "Nor bi God send dis man, bikos e nor sopoz to du eni wok for Sabat Day." Bot odas sey, "Haw pesin wey dey komit sin go fit du dis kaind mirakol?" Dis argument kon mak di pipol divide.

17 Dem kon ask di man wey blind bifor sey, "Wetin yu tink abaut di man wey mak yu dey si?" Di man ansa, "Na profet e bi."

18 Di Ju oga dem nor gri biliv sey, tru-tru di man blind bifor, so dem kon kol en papa and mama.

19 Dem kon ask dem, "Na una pikin bi dis? Na tru sey e blind wen una born am? Haw e kon tak dey si naw?"

20 So en papa and mama ansa, "Wi no sey dis na awa pikin and e blind wen wi born am.

21 "Bot wi nor no haw e tak bigin si or ivun hu opun en eye. Mak una ask am, e don big rish to tok for ensef."

22 (En papa and mama tok laik dis, bikos dem dey fear di Ju oga dem wey don tok sey, "Enibodi wey tok sey na Jisos bi di Kraist, dem go driv am komot from di sinagog."

23 Na dis won mak en papa and mama sey, "Mak dem ask am, bikos e don big rish to tok for ensef)".

24 So dem kol di man again kon tel am, "Mak yu promis bifor God sey yu go tok di trut, bikos wi no sey di man na sina."

25 E kon ansa dem, "Weda na sina e bi, I nor no! Bot wetin I no bi sey, bifor I blind, bot naw, I don dey si."

26 So dem ask am again, "Wetin e du? Haw e tak mak yu dey si sef?"

27 E kon ansa dem, "I don tel una bifor, bot una nor gri. Why una won hear am again? Abi, una won bi en disaipols tu?"

28 Dem shaut for di man kon sey, "Na yu bi en disaipol. Wi bi Mosis disaipols.

29 "Wi no sey God tok to Mosis, bot wi nor no wer dis man from kom."

30 Di man kon sey, "I sopraiz for una o-o. Una nor no wer e from kom, bot na-im opun my eye!

31 "Wi no sey God nor dey listin to enibodi wey dey sin, bot if pesin dey du wetin God tok, God go hear en praya.

32 "Wi neva hear bifor sey, enibodi don fit mak pesin wey blind si.

33 'If God nor send dis man, e nor go fit du dis kaind tin."

34 Dem kon tel di man, "Na for insaid sin dem born yu, yu tink sey yu go fit tish us enitin?" So dem driv am komot from di place.

35 Wen Jisos hear sey dem don driv di man komot, e go luk for am kon ask am, "Yu biliv hu Man Pikin bi?"

36 Di man kon sey, "Oga, tel mi hu e bi, mak I for fit biliv am?"

37 Jisos ansa am, "Na-im dey here dey tok to yu so."

38 Di man kon sey, "Oga, I biliv." Den e nil dan kon woship Jisos.

39 Jisos tel am, "I kon joj pipol for di wold, so dat di pipol wey nor dey si, go bigin si and doz wey tink sey dem dey si, dia eye go blind."

40 Wen di Farisi pipol wey dey der hear wetin Jisos tok, dem kon ask am, "Yu tink sey wi sef blind?"

41 Jisos ansa dem, "If una gri sey una blind, God nor go kondem una bikos of una sin, bot as una tok sey una dey si so, una sin dey for una head."

Open Bible reader