Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 6

1 Wen Jisos don tok finish, e kon kros go Tiberias wey dey di oda side for Galili wotasaid.

2 Plenti pipol kon dey folo am, bikos dem si wen e heal sik pipol.

3 Jisos kon komot for der go di mountin side kon sidan der wit en disaipols.

4 (Dat taim, Passova Fist don rish.)

5 And wen Jisos luk up, e si plenti pipol dey kom mit am. Den e kon ask Filip, "Na wer wi go fit si bread buy wey all dis pipol go chop?

6 Jisos tok dis won mak e for si wetin Filip go du, bikos en ensef no wetin e won du.

7 Filip ansa, "Ivun if wi buy bread wey rish tu ondred silva koins and if dem share am smol-smol, e nor go rish evribodi chop.".

8 Anoda disaipol wey en name bi Andru, wey bi Saimon Pita broda kon tel Jisos sey,

9 "Won boy dey here wey get faiv bread and tu fish, bot dis won nor go rish dis plenti pipol chop beleful?"

10 Jisos ansa, "Tel all di pipol mak dem sidan (as plenti grass dey di place wey dem go fit sidan put). Di men wey sidan, rish faiv tazon.

11 Jisos tak di bread kon tank God. Den e divide am giv di pipol wey sidan. E du di same tin wit di fish. All of dem chop as dem wont, kon beleful wel-wel.

12 Wen evribodi don beleful, Jisos kon tel en disaipols, "Mak una gada wetin rimain, mak enitin nor waste."

13 Wen dem gada wetin dem chop rimain for di faiv bread, e ful twef basket.

14 So wen di pipol si di mirakol wey Jisos du, dem kon dey tok among demsef sey, "Tru-tru, dis man na di profet wey God send kom dis wold."

15 Since Jisos no sey dem go won tak am by fos go mak am dia king, e kon komot go on-top di mountin alone.

16 Wen evenin rish, en disaipols kon go wotasaid go wait am,

17 dem enta won kenu, kros go Kapanum (by dis taim, evriwer don dey dak and Jisos neva kom mit dem.)

18 Den strong briz bigin blow and di riva kon dey ruff wel-wel.

19 Wen dem don padol di kenu go rish abaut tiri or for miles, dem si Jisos dey waka on-top di wota dey kom near dem. Fear kon kash dem wel-wel.

20 Jisos kon tel dem, "Na mi, mak una nor fear."

21 As dem dey trai mak e enta insaid di kenu, dem kon si sey di kenu don rish wer dem dey go.

22 Wen day don break, di pipol wey dey di oda side for di riva no sey na onli won smol kenu dey der. Dem stil no sey Jisos enta di kenu wit dem.

23 So som kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotasaid near di place wey dem for chop bread, afta Jisos don pray.

24 So wen di pipol si sey Jisos and en disaipols nor dey der, dem enta di kenu kon go luk for Jisos for anoda tawn wey dem dey kol Kapanum.

25 Wen dem si Jisos for di oda side for di riva, dem ask am, "Tisha, wish taim yu kom here?"

26 Jisos ansa dem, "Mak I tel una tru wod, na bikos of di bread wey una chop naim mak una dey faind mi, nor bi bikos of di mirakols wey una si.

27 "Mak una nor wok for fud wey nor dey last, bot for fud wey go giv una life wey nor dey end and dat kaind fud, na onli Man Pikin go fit giv una, bikos na-im God send kom."

28 Dem kon ask am, "Wetin wi go du to mak God hapi wit us?"

29 Jisos ansa, "God wont sey mak una biliv di pesin wey E send."

30 Dem stil ask Jisos, "Wish kaind mirakol yu go du mak wi si, mak wi for biliv yu?

31 "Awa gran papa dem chop manna for widanes as dem rite for God wod sey, 'God giv dem bread from hevun to chop.'"

32 Den Jisos kon tel dem, "Mak I tel una tru wod, nor bi Mosis giv una bread from hevun, bot God, wey bi my Papa, na-im giv una di tru bread from hevun.

33 God bread na di pesin wey kom dan from hevun kon giv beta life to di pipol wey dey dis wold."

34 So dem tel am, "Oga, from naw go, mak yu giv us dis bread."

35 Jisos kon tel dem, Na mi bi di bread wey dey giv life. Pesin wey kom mit mi nor go hungri lia-lai and di pesin wey biliv mi, nor go hungri for wota again.

36 As I don tel una, una dey si mi, bot una nor biliv.

37 "Enibodi wey my Papa giv mi, go kom mit mi and wen e kom, I nor go eva driv am.

38 "Nor bi to du wetin I wont mak mi kom dan from hevun, bot na to du wetin my Papa wont.

39 "Wetin my Papa wey send mi wont, na mak I nor luz enibodi wey e giv mi, bot mak I for tak dem go up for di last day.

40 "Wetin my Papa wont bi sey, enibodi wey biliv en pikin, go get life wey nor dey end and I go wak-am up for di last day."

41 Den di Ju pipol bigin ves and komplian abaut Jisos, bikos e tok sey, "Na mi bi di bread wey kom dan from hevun."

42 Den dem kon sey, "Dis Jisos sef nor bi Josef pikin, wey wi no en papa and mama? Na haw e kon dey tok sey, 'I kom dan from hevun?'"

43 Jisos ansa, "Mak una nor komplain abaut mi to won anoda.

44 "Nobodi go fit kom mit mi wit en own pawa, unles my Papa wey send mi draw am kom mit mi and I go tak am go up for di last day.

45 "Na so di profets rite sey, 'God go tish evribodi.' Enibodi wey hear wetin my Papa tok, go kom mit mi.

46 (Nor bi sey enibodi don si di Papa bifor, esept mi wey kom from hevun).

47 "I dey tel una tru wod, enibodi wey biliv mi, don get life wey nor dey end.

48 "Na mi bi di bread wey dey giv pesin life.

49 "Una gran-gran papa dem chop manna for widanes, bot dem stil die.

50 "Dis na di bread wey kom from hevun, so dat enibodi wey chop am, go get life wey nor dey end.

51 "Na mi bi di bread wey kom dan from hevun. Enibodi wey chop dis bread go liv foreva. Na my flesh bi di bread wey I go giv di pipol wey dey for dis wold."

52 Den di Ju pipol wey dey ves wit Jisos kon bigin dey argue wit won anoda dey sey, "Haw dis man go giv us en flesh mak wi chop?"

53 Jisos tel dem, "I dey tel una tru wod, unles una chop Man Pikin flesh and drink en blood, una nor go get life for insaid una.

54 "Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood, don get life wey nor dey end and I go tak am up for di last day.

55 "My flesh na di ril fud and my blood na di koret drink.

56 Di pesin wey chop my flesh and drink my blood, go stay insaid mi and I go dey insaid am tu.

57 "Na my Papa wey dey for hevun send mi and as I dey for dis life bikos of am, na so di pesin wey chop my flesh go get life, bikos of mi.

58 "Dis na di bread wey kom dan from hevun, e nor bi laik di bread wey una gran papa dem chop and afta, dem stil die. Di pesin wey go chop dis bread nor go eva die, bot e go liv foreva."

59 Jisos tok dis tins wen e dey tish dem for insaid di Tempol for Kapanum.

60 Wen Jisos meni disaipols hear wetin e tok, dem kon sey, "Dis tin wey Jisos dey tok so hard wel-wel-o-o! Na hu go fit undastand dem?"

61 Wen Jisos no sey en disaipols dey komplain abaut wetin e tok, e kon ask dem, "Wetin I tok so dey mak una ves tu?

62 "Wetin go hapun if una si Man Pikin go bak to hevun wer e dey bifor?

63 "Na di Spirit go fit giv pesin life; humanbin pawa nor fit du-am. All dis wod wey I dey tel una so, dem bi Spirit and dem dey giv pesin life.

64 "Bot som of una nor biliv." (From biginin, Jisos don no di pipol wey nor go biliv and di pesin wey go sel am giv en enemi.)

65 So Jisos kon sey, "Na bikos of dis I tel una sey, nobodi go fit kom mit mi wit en own pawa, unles my Papa let am kom."

66 Afta dis, Jisos meni disaipols kon stop to folo am.

67 Den Jisos kon ask en twef disaipols, "Una won go tu?"

68 Den Saimon Pita ansa am, "Oga, na hu wi go kon go mit? Na yu get di wod wey dey giv pipol di life wey nor dey end.

69 "Wi don biliv and no sey, 'Na yu bi di Holi Won wey God send kom mit us.'"

70 Jisos kon ansa, "Nor bi twef of una I shuz? Bot won pesin among una na devol pikin."

71 (E tok dis won abaut Judas, wey bi Saimon Iskarot pikin, bikos na dis Judas, wey bi won of en twef disaipols, naim go sel am giv en enemi.)

Open Bible reader