Nigerian Pidgin Bible
John 4
1 Jisos kon no sey di Farisi pipol don hear sey e dey baptize plenti pipol pas Jon and di pipol dey folo am,
2( aldo nor bi Jisos ensef dey baptize pipol, bot na en disaipols dey du-am).
3 Jisos kon komot for Judea dey go Galili.
4 For am to rish der, e go must pas tru Samaria.
5 E kon rish won tawn for Samaria wey dem dey kol Sykar, wey near di land wey Jakop giv Josef, wey bi en pikin.
6 Jakop wel dey der tu. Dat aftanun, bikos Jisos don taya to waka, e kon sidan near di wel.
7 So won wuman for di tawn kom draw wota for di wel. Jisos tel am, "Abeg giv mi wota mak I drink".
8 By dis taim, en disaipols don go insaid di tawn go buy fud.
9 Den di wuman kon tel Jisos, "Haw yu wey bi Ju kon dey ask mi wey bi Samaria pesin, sey, "Mak I giv yu wota drink?'" (E tok dis won bikos Ju and Samaria pipol nor dey agri at-all.)
10 Jisos ansa am, "If yu no wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go giv yu di wota wey dey mak pesin liv foreva."
11 Di wuman ask am, "Oga, yu nor get bucket and di wel deep wel-wel, wer yu go fit get dat kaind wota?"
12 "Yu big pas awa gran papa Jakop wey giv us dis wel, wer en famili and animas dey drink from?"
13 Jisos ansa, "Pesin wey drink from dis wota go always dey hungri for wota.
14 "Bot enibodi wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hungri for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to riva wey nor dey dry insaid en bele and di wota go gi-am life wey nor dey end."
15 Di wuman kon tel am, "Oga, giv mi dis wota, so dat I nor go hungri for wota or kom here kon draw wota again."
16 Jisos tel am, "Go kol yor husban, mak tu of una kom mit mi."
17 Di wuman ansa, "I nor get husban." Den Jisos kon tel am, "Yu tok tru wen yu sey 'I nor get husban.'18"Bikos yu don mari faiv husban bifor and di man wey yu dey stay wit naw, nor bi yor ril husban. Na tru yu tok."
19 Di wuman kon tel am, "Oga, I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go hapun.
20 "Awa papa dem serv God for dis mountin, bot una kon tok sey, di place wey pipol sopoz to woship God, na Jerusalem e dey."
21 Jisos kon sey, "Wuman, mak u biliv mi, di taim dey kom, wen pipol go woship God for eniwer dem dey, nor bi onli for dis mountin or for Jerusalem.
22 "Una dey serv wetin una nor no, bot wi dey serv wetin wi no, bikos na Ju pipol, naim God first kol to ensef.
23 "Bot di taim dey kom and e don ivun rish, wen di pipol wey won rili serv God, go serv am for di tru way, wey God Spirit go show dem.
24 "God na Spirit and di pipol wey won serv am, must serv am for di tru way wey God Spirit go show dem."
25 Di wuman ansa, "I no sey di Mezaya (di won wey dem dey kol Kraist), wey go save evribodi, go kom and enitaim wen e kom, e go tel us evritin."
26 Jisos kon tel am, "Na mi wey dey tok to yu so, bi di Mezaya."
27 Wen Jisos dey tok to di wuman, en disaipols kon kom bak. Dem sopraiz sey e dey tok wit won wuman, bot dem nor fit ask am, "Wetin e wont?" or "Why e dey tok to di wuman?"
28 By dis taim, di wuman don liv en pot wey e tak kom draw wota kon run go insaid di tawn go tel pipol sey,
29 "Mak una kon si won man wey tel mi all di tins wey I don du. Dis man nor bi di Mezaya so?"
30 So di pipol kom out for di tawn go mit Jisos.
31 By dis taim, di disaipols kon beg am, "Tisha, mak yu chop somtin naw."
32 E tel dem, "I get fud wey I go chop wey una nor no abaut."
33 Di disaipols kon dey ask demsef, "Abi sombodi don bring somtin for am to chop wen wi nor dey here?"
34 Jisos kon tel dem, "My fud na to du wetin my Papa tok and mak I finish di wok wey E send mi.
35 "Nor bi una dey tok sey, 'Na for monts rimain bifor dem go plok frut wey dem plant for farm?' Mak una luk roun and una go si sey frut don ripe rish to plok.
36 "God go riword di pesin wey plok plenti frut from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go hapi togeda.
37 "Dis won show sey, di tin wey pipol dey tok sey, 'Won pesin plant and anoda pesin plok di friut', na tru wod.
38 "I send una go plok wetin una nor plant, oda pipol don sofa plant dem, bot una kon enjoy wetin dem sofa for."
39 By dis taim, meni pipol from Samaria tawn kon biliv am, bikos of di tins wey di wuman tok, "E tel mi all di tins wey I don du."
40 Wen Samaria pipol kom mit am, dem kon dey beg am sey, mak e stay wit dem. So e kon stay der for tu days,
41 and bikos of wetin e tok, meni pipol kon biliv am.
42 Den dem kon tel di wuman, "Nor bi wetin yu tel us mak us biliv, bot bikos wi don tak awa own ear hear and wi don no sey, dis pesin tru-tru, na-im go save all di pipol wey dey dis wold."
43 Wen tu days pas, Jisos komot from der go Galili.
44 (Bikos Jisos don tok am sey, "Pesin wey bi profet nor dey get respet for en home-tawn").
45 Wen e rish Galili, di pipol wey dey der kon welkom am, bikos dem don si all di tins wey e du for Jerusalem for di taim wen dem dey du Passova Fist.
46 Again, e go Kana wey dey Galili, for wer e first turn wota to wine. For Kapanum, won soja-man wey dey wok for di king palise dey der and en pikin wey nor wel.
47 Wen e hear sey Jisos don kom bak to Galili, e go mit am kon beg am sey mak e kom heal en pikin wey won die.
48 So Jisos ask am, "If una nor si signs and wondas una nor go biliv mi?"
49 Di man ansa, "Oga, abeg mak yu kom bifor my pikin go die."
50 Jisos kon tel am, "Mak yu go haus, yor pikin nor go die." Di man biliv wetin Jisos tel am, so e kon komot go en haus.
51 Wen e don near haus, en savants kon mit, tel am sey, "Yor pikin don wel, e nor die."
52 So, e ask dem di taim wen di pikin bigin dey beta. Dem kon tel am, "Na yestaday for won o' klok for aftanun naim e wel."
53 Bikos of wetin dem tok, di pikin papa kon rimemba sey dat na di taim wen Jisos tel am sey, "Yor pikin nor go die." Bikos of dis, di man and evribodi wey dey en haus kon biliv Jisos.
54 Dis na di sekon mirakol wey Jisos du for Galili, afta e kom bak from Judea.