Nigerian Pidgin Bible
John 14
1 "Mak una nor let enitin wori una maind. Since una biliv God, mak una stil biliv mi.
2 "Meni rooms dey for my Papa haus and I dey go priper place for una to stay, if nor bi so, I for tel una.
3 "Wen I don finish, I go kom tak una, so dat una go stay wit mi for wer I dey.
4 "And una go no di place wey I dey go and haw una go tak rish der."
5 Tomas kon ask am, "Oga, wi nor no wer yu dey go, haw wi go tak no road?"
6 Jisos ansa am, "Na mi bi di road, di trut and life. Nobodi go fit go mit my Papa, unles e pas tru mi.
7 "Bot since una don no mi, una go no my Papa tu. Naw wey una don no am, una don si-am."
8 Filip kon sey, "Oga, show us yor Papa and wi go dey okay."
9 Jisos ansa am, "So Filip, I don dey wit una all dis taim and yu stil nor no mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, 'Show us yor Papa?'
10 "Yu nor biliv sey mi and my Papa na di same? As e dey insaid mi, na so I dey insaid am. Di wod wey I dey tel una so, I nor dey tok am wit my own pawa, bot na my Papa wey dey insaid mi, dey du all dis mirakol tru mi.
11 "Mak una biliv sey I dey insaid my Papa and my Papa dey insaid mi, bot if una nor fit biliv mi, mak una biliv bikos of di mirakols wey I dey du.
12 "I tel una tru wod, di pesin wey biliv mi, go du di kaind mirakol wey I dey du and e go ivun du di wons wey big pas dem, bikos I dey go mit my Papa.
13 "And enitin wey una yuz my name ask, I go du-am, so dat pipol go onor di Papa bikos of en pikin.
14 "If una ask enitin wit my name, I go du-am for una.
15 "If una luv mi, una go du wetin I tok.
16 "Den I go ask my Papa and E go send una anoda Pesin wey go help and stay wit una foreva.
17 "Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis wold nor go fit risiv, bikos dem nor fit si-am or no am, bot una no am, bikos e dey stay insaid una.
18 "I nor go liv una laik pikin wey nor get papa and mama, bikos I go kom mit una again.
19 "Afta somtaim, di pipol for dis wold nor go si mi, bot una go si mi and bikos I dey alaif, una go dey alaif tu.
20 "Dat taim, una go no sey I dey insaid my Papa and una dey insaid mi, as I dey insaid una.
21 "Enibodi wey hear and du wetin I tok, luv mi. Di pesin wey luv mi, mi and my Papa go luv am tu and I go show am hu I bi."
22 Judas (dis nor bi Judas Iskarot) kon sey, "Oga, why yu won show yorsef giv us and yu nor won show oda pipol for di wold?"
23 Jisos ansa am, "Enibodi wey luv mi, go du wetin I tok and my Papa go luv am, wi go kon mit and stay wit am.
24 "Di pesin wey nor luv mi, nor go du wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my wod, bot na my Papa own.
25 "I don dey tel una all dis tins since I dey wit una.
26 "Bot di pesin wey go help una na di Holi Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una rimemba evritin wey I don tel una.
27 "Mak una maind res, bikos na my peace I giv una. My peace difren from di won wey di wold dey giv. Mak una nor fear or alow enitin wori una maind.
28 "Una rimemba wen I tel una sey, 'I dey komot and I go kom bak kon mit una?' If una luv mi, una go hapi wen I tok sey, 'I dey go mit my Papa', bikos my Papa big pas mi.
29 "I don tel una naw bifor e hapun, so dat wen e hapun, una go biliv mi.
30 "I nor go tok tu mush naw, bikos di devol wey dey rule dis wold, dey kom and e nor get pawa for my bodi.
31 "Since I dey du wetin my Papa tel mi, di wold go no sey I luv my Papa. So mak una get up mak wi dey go."