Nigerian Pidgin Bible
John 11
1 Won man wey en name bi Lazarus wey nor wel. En wit Mary and Marta, en sistas kom from Betani.
2 Dis Mary naim pour perfume for Jisos leg, kon klin dem wit en hair.
3 So di sistas kon send mesage go mit Jisos sey, Oga, yor frend wey yu luv wel-wel wey nor wel.
4 Wen Jisos hear di mesage, e kon sey, "Dis siknes nor go kil Lazarus. E go mak God and en pikin get onor."
5 (E klear sey Jisos luv Marta, Mary and Lazarus wel-wel.)
6 Afta e don hear sey Lazarus nor wel, e stay wer e dey for anoda tu days.
7 Den e kon tel en disaipols, "Mak wi go bak to Judea."
8 Bot en disaipols kon ask, 'Tisha, nor bi di place wer di Ju pipol won for kil us yu sey mak wi go again so?
9 Jisos ansa, "Evriday get twef hours wey lite dey tak shine, so pipol nor dey fear to waka, bikos dem dey si wel-wel, as e bi sey lite dey.
10 Bot pesin wey waka for nite, go fit fal, bikos e nor get lite to si road."
11 Den Jisos tel dem, "Awa frend Lazarus dey slip, bot I won go wak-am up."
12 Di disaipols sey, "Oga, if e jos dey slip, den e go wak-up."
13 (Dem tink sey, wetin Jisos min bi sey, Lazarus jos dey slip, bot wetin e min bi sey, Lazarus don die.)
14 So e kon tel dem sey, "Lazarus don die.
15 "I hapi sey I nor dey der, so dat una go get anoda shanse to biliv mi. Mak una kom mak wi go si-am."
16 So Tomas, (wey bi Twins) kon tel di oda disaipol, "Mak wi folo am go, so dat wi go die wit am."
17 Wen Jisos rish Betani, dem kon tel am sey e don rish for days wey dem bere Lazarus.
18 (Betani na abaut tu miles from Jerusalem,
19 and from der, meni Ju pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.)
20 So wen Marta hear sey Jisos dey kom, e kon waka go mit am, bot Mary sidan for haus.
21 Marta kon tel Jisos, "Oga, if to sey yu dey here, my broda for nor die."
22 Bot I no sey, "God go giv yu enitin wey yu ask am."
23 So Jisos tel am, "Yor broda go wak-up again."
24 Den Marta sey, I no sey e go wak-up again for di resureshon day."
25 Jisos ansa am, "Na mi bi di resureshon and na mi dey giv life. Enibodi wey biliv mi go get life ivun if e don die,
26 and di pesin wey biliv mi for dis life, nor go eva die. Marta, yu biliv wetin I tok so?"
27 Marta kon ansa, "Yes! Oga, I biliv sey yu bi Kraist, God Pikin, wey kom dis wold."
28 Den Marta go mit Mary, en sista, kon tok for en ear sey, "Di tisha dey here and e won si yu."
29 Wen Mary hear wetin e tok, e kon get up go mit Jisos.
30 Jisos stil dey outsaid di vilage wen Marta go mit am.
31 Di pipol wey kom salot Mary kon si haw e waka komot kwik-kwik, dem tink sey na Lazarus grave e for dey go krai, so dem folo am.
32 Wen Mary si Jisos, e fal for en front kon sey, "Oga, if to sey yu dey here, my broda nor for die."
33 Jisos kon si as Mary and di oda pipol dey krai. So e sori for dem and di tin pain am wel-wel.
34 E kon ask dem, "Wer una bere am?" Den dem tel am, "Oga, kom mak wi show yu."
35 Jisos kon krai.
36 Di pipol wey kom salot dem kon sey, "Jisos luv dis man wel-wel o-o."
37 Bot som of dem sey, "Dis man wey mak blind man si, e nor fit du mak Lazarus nor for die?"
38 Jisos kon sori for dem again, den e waka go di grave. (Dis grave na big hol insaid rock wey dem tak big stone kova).
39 Jisos kon sey, "Mak una rimov di stone." Marta wey bi Lazarus sista kon sey, Oga, by dis taim e go don dey smel, bikos e don rish for days wey dem bere am."
40 Jisos tel am, "I nor tel yu bifor sey, 'Yu go si God pawa, if yu biliv mi?'"
41 So, dem kon rol di stone komot from di grave mout. Den Jisos luk hevun, kon sey, "Papa, I tank yu sey Yu dey always hear mi and dey du di tins wey I ask from Yu."
42 I no sey Yu dey always hear mi, bot I dey tok laik dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go biliv sey na Yu send mi."
43 Wen e don tok dis finish, e kon shaut, "Lazarus, kom out!"
44 Den Lazarus kon kom out, bot di klot wey dem tak bere am stil kova en bodi. So, Jisos tel dem, "Mak una luz di klot komot for en bodi, mak e dey go."
45 Den meni of di Ju pipol wey folo Mary go di gravside biliv Jisos, wen dem si wetin hapun.
46 Bot som of dem go mit di Farisi pipol kon tel dem wetin Jisos du.
47 Den di prist oga dem and Farisi pipol kon kol di kansol memba dem togeda, ask dem, "Wetin wi go du, since di man dey du plenti mirakols?
48 "If wi let am kontinu laik dis, evribodi go biliv am and di Roman govnor go kom tak di place wey wi dey woship and awa kontri."
49 Den won of dem wey en name bi Kaifas, wey bi di High Prist dat year, kon sey, "Una bi fool wey nor undastand wetin dey hapun.
50 "Una nor no sey e beta mak won man die for evribodi, dan sey mak evribodi for dis kontri die?"
51 (Dis man tok laik dis, bikos naim bi di High Prist dat year. E tok tru sey, Jisos go die for di hol Ju pipol, bot e nor no wetin e tok,
52 and nor bi for onli di Ju pipol, bot mak all God shildren, wey dey di wold for gada togeda.)
53 So from dat day, dem kon dey plan to kil Jisos.
54 Bikos of dis, Jisos nor kon dey waka for Judea as e dey du bifor, bot en and en disaipols kon go stay for di tawn wey dem dey kol Efraim, wey near desert.
55 Wen Passova Fist don near, meni pipol for di kontri go Jerusalem, kon dey mak demsef klin for di fist, as dia tradishon tok.
56 Dem bigin dey luk for Jisos kon dey ask ish oda insaid di Tempol yard, "Wetin yu tink, e go kom for di fist?" Abi yu nor tink so?
57 (By dis taim, di prist oga dem and di Farisi pipol don giv orda sey, enibodi wey no wer Jisos dey, mak e kon tok, so dat dem go-go kash am).