Nigerian Pidgin Bible
Jeremiah 48
1 Na wetin Almighty God talk about Moab be this: Make una pity people of Nebo - their towm don destroy! Dem don capture Kiriathaim, hin strong wall don fall, and shame don catch hin people;
2 The glory of Moab don go. Enemy don capture Heshbon and dem don plan to destroy the nation of Moab. The town of the madmen go destroy; armies go attack am.
3 The people of Horoniam dey cry out, Violence! Destruction!
4 Moab don destroy; make una hear the children dey cry.
5 Make una hear the sound of their cry along the road to Luhith, the city of pain on the way down to Horonaim.
6 Dem talk say Make una run quick for una lives! Make una run like wild desert donkey!
7 Moab, you trust in your strength and your wealth but now dem go defeat you; your god Chemosh go run go foreign country, with all him prince and priest.
8 Not even a town go escape the destruction; both valley and plain go destroy. I, the LORD, don talk.
9 Make una set up gravestone for Moab; e go destroy soon. Hin towns go perish and nobody go live for there again.
10 Bad things go happen to those wey no do the work of God with all their heart and those wey no use their sword to cut or kill!
11 God talk say, Moab don dey always live safe and dem never take am go strange land before. Moab be like wine wey dem no disturb and allow to settle and wey dem never pour from jar to jar. Hin flavor never spoil, and hin taste still dey good as e dey always be.
12 So now, the time dey come when I go send people to pour out Moab like wine. Dem go empty hin wine jar and break them to pieces.
13 Then people of Moab go dey dissapointed with their god Chemosh, just as the people of Israel dey disappointed with Bethel, the god wey dem trust.
14 Men of Moab, why una claim say una be heroes, brave soldier wey dem test for war?
15 Moab and hin cities don destroy; dem don kill hin young men wey fine pass. I be the king, the LORD Almighty, and I don talk.
16 Destruction of Moab don near; the time wey e go perish dey come soon.
17 Make una cry for that nation, una wey dey live near by, all of una wey know hin fame. Make una say, hin powerful rule don break; hin glory and might don go.
18 Una wey dey live for Dibon, make una come down from una place of honour and make una sit for ground inside dust; people wey go destroy Moab don come, and dem don destroy hin strong wall.
19 Una wey dey live for Aroer, make una stand for road and wait; make una ask those wey dey run away, make una find out from them wetin don happen.
20 Dem go answer say. Moab don fall, make una cry for am; shame don catch am. Make una announce along River Arnon say Moab don destroy!
21 Judgement don come on top cities for highland: on top Holon, Jahzah, Mephath,
22 Dibon, Nebo, Beth Diblathaim,
23 Kiriathaim, Bethgamul, Bethmeon,
24 Kerioth, and Bozrah. Judgement don come on all cities of Moab, far and near.
25 Dem don crush Moab force, hin power don destroy. I, the LORD, don talk.
26 God talk say, Make Moab drunk because he don disobey me. Moab go roll inside him own vomit, and people go laugh.
27 Moab, remember how you take laugh at people of Israel? You treat them like like say you don catch them with gang of robbers.
28 You people wey dey live for Moab, make una leave una town! Make una go live on top rock! Make una be like dove wey make hin nest for the side of narrow water way.
29 Moab dey very proud! I don hear how proud, arrogant, and selfish the people be, dem dey always think of themselves only.
30 I, the LORD, know of their strong head. Their boast no be anything, and the thing wey dem dey do no go last.
31 And so I go cry for everybody wey dey Moab and for the people of Kir Heres.
32 I go cry for people of Sibmah, even pass the people of Jazer. City of Sibmah, una be like vine wey hin branches dey reach across the Dead Sea and go far reach Jazer. But now una summer fruit and una grape don spoil.
33 Happiness and joy no dey the good land of Moab again. I don make the wine stop to dey flow from where dem dey make wine; nobody dey to make the wine and shout for joy.
34 The people of Heshbon and Elealeh cry out, and person fit hear their cry from far distance like Jahaz; people wey dey Zoar fit hear them, and dem hear am for far places like Horonaim and Eglath Shelishiyah. Even the stream of Nimrim don dry.
35 I go stop the people of Moab to dey make burnt offering for the place of worship and to dey offer sacrifice give their gods. I, the LORD, don talk.
36 So my heart dey cry for Moab and for people of Kir Heres, like person wey dey use flute play funeral song, because everything wey dem get don go.
37 All of them don shave their head and dem don cut their beards. All of them don cut their hand, and everybody dey wear sackcloth.
38 Nothing dey for every housetops of Moab and for all public square but cry, because I don break Moab like a pot wey nobody want.
39 Moab don break! Cry out! Shame don catch Moab. E don perish, and all the nation wey surround am dey mock am. I, the LORD, don talk.
40 God don promise say a nation go attack Moab like an eagle wey spread hin wings,
41 and dem go capture the towns and strong walls. On that day soldier of Moab go dey fear like woman wey dey labour.
42 Moab go perish and e no go be nation again, because e don disobey me.
43 Terror, pits, and traps dey wait for the people of Moab. God don talk.
44 Anybody wey wan try escape the terror go fall inside the pit, and anybody wey climb out of the pit, the trap go catch am, because God don set the time to destroy Moab.
45 Helpless people wey run from war try go find protection for Heshbon, the city wey king Sihon don rule before, but fire don catch am. Fire don dey burn the leaders and the proud people of Moab.
46 Make una pity the city of Moab! The people wey worship Chemosh don destroy, and dem don take away their sons and daughters as prisoner.
47 But God go make Moab prosper again in days to come. All of this na wetin God don talk say e go happen to Moab.