Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

James 5

1 Yu wey get moni, mak yu listin! Krai mak dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go hapun to yu.

2 Yor moni don rotin and ants don chop yor klot.

3 Yor gold and silva don rust, dia ashes go tok against yu and chop yor flesh laik fire. For di last days, yu don gada moni and fine tins for yorsef!

4 Si, di moni wey yu nor gri pay di wokas wey dey wok for yor farm, dey krai against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia krai don rish God ear.

5 Yu dey liv life wey yu dey enjoy and yu dey enjoy for dis eart. Yu don mak yorsef fat, dey wait for di day wey dem go kil yu.

6 Yu don kondem and kil pipol wey nor du bad, bikos dem nor fit stop yu.

7 My brodas and sistas, mak una get patient til Kraist go kom bak. Tink haw farma dey wait for wetin e plant ontil e grow kon bring fud wey dear and e dey wait wit patient for am, ontil di first and di last rain go fal put.

8 So, mak una get patient tu and mak una heart strong, bikos di taim wen Kraist go kom bak, don near.

9 My brodas and sistas, mak una nor dey komplain abaut ish oda, so dat dem nor go joj una, bikos God wey bi di joj, stand near di gate.

10 Di profets wey God send kom tok to una, mak una yuz dem as ezampol to bear sofa and get patient.

11 Mak una tink of haw wi dey luk pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una don hear of haw Job get patient and haw God bless am lata. God get mesi and E dey sori for pesin wel-wel.

12 My brodas and sistas, mak una rimemba dis komand pas oda wons; mak una nor swear, weda wit hevun or eart or eni oda tin. Bot mak una let una "Yes" bi yes, and una "No" bi no, so dat una nor go fal enta God jojment.

13 If enibodi dey sofa among una, mak e pray. If enibodi dey hapi among una, mak e sing dey praiz God.

14 If eni of una nor wel, mak e kol di eldas for di shosh, mak dem pray and yuz oil anoint am for Jisos name.

15 Di praya wey dem tak fate pray go save di pesin wey nor wel and God go mak am wel. And if e komit eni sin, God go forgiv am.

16 So mak una konfes una sin to ish oda. Mak una pray for ish oda, so dat God go heal una. Di praya wey pesin wey gud for God eye tak all en maind pray, dey wok wel-wel.

17 Elija na humanbin laik us and e pray wit all en maind mak rain nor fal, tru-tru, for tiri and half years, rain nor fal for dat place at-all.

18 Den e pray again and di skai kon bring rain and evritin wey dem plant, kon grow.

19 My brodas and sistas, if eni of una waka komot from di trut and pesin bring am kom bak,

20 mak yu no sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom bak from di bad way, don save yor soul from deat and e don mak Kraist forgiv yu all yor sins.

Open Bible reader