Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

James 4

1 Wetin dey mak una kworel and fite? Nor bi di tins wey dey hungri una to du?

2 Yu wont somtin, bot yu nor get-am; yu dey kil, dey wont wetin oda pipol get and yu nor dey fit get-am; so yu go kon dey kworel and fite. Yu nor get, bikos yu nor ask God mak E giv yu.

3 Wen yu ask for somtin, yu nor risiv am, bikos yu nor ask wel and yu won tak am du wetin yu laik.

4 Una wey dey du bad tins for dis wold, una nor no sey to bi dis wold frend, min sey una bi God enimi? So enibodi wey gri sey en and dis wold na frend, don mak ensef God enimi.

5 Abi yu tink sey God nor min wetin E tok wen E sey, "Di Spirit wey I put insaid una dey jelos wel-wel"?

6 Bot E giv us plenti grace. Na dis mak God wod sey, "God dey against pesin wey dey kari bodi up, bot E dey giv grace to pipol wey dey put dia bodi dan."

7 So, mak yu giv yorsef to God. Bot rejet di devol and e go run komot from wer yu dey.

8 Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, mak una wosh una hand and una wey get doubol maind, mak una heart dey klin.

9 Mak una krai and mak sorrow dey una heart, den una go show sey una nor dey hapi.

10 If una put una bodi dan for God, E go kari una go up.

11 My brodas and sistas, mak una nor tok bad abaut ish oda. Enibodi wey tok bad or joj en broda or sista for Kraist, e dey tok bad abaut di law and e dey joj di law. Bot if una joj di law, naim bi sey una nor dey obey di law, bot una don bikom di law joj bi dat.

12 Na onli won Pesin giv di law and na-im bi joj. Na-im dey save and distroi. Yu wey dey joj yor nebor, na hu yu ivun tink sey yu bi?

13 Luk, yu wey dey sey, "Today or tumoro, wi go-go dis or dat tawn go stay der for won year and du biznes, kon get gain."

14 Bot yu nor no tumoro. Wetin yor life bi laik? Yu bi laik smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si-am, den smol taim e go vanish.

15 Insted, yu sopoz to sey, "If God wont, wi go dey alaif and wi go du dis or dat tin."

16 Bot as e bi so, yu dey boast dey kari bodi up. All dat kaind boastin nor gud.

17 So enibodi wey no wetin gud and e nor du-am, don komit sin bi dat. James

Open Bible reader