Nigerian Pidgin Bible
James 2
1 My brodas and sistas, since una get fate for awa Oga Jisos Kraist, mak una nor dey du parsha.
2 If pesin wear gold ring and fine klot enta una shosh and poor pesin wit dirti klot enta tu
3 and una respet di won wey wear fine klot, kon tel am, "Sidan for beta place," bot una tel di poor pesin, "Stand der," or "Sidan for groun":
4 Dat min sey una dey du parsha and kondem pipol from una maind.
5 My brodas and sistas, mak una listin! God nor shuz poor pipol for dis wold sey, mak dem rish for fate and inherit di kindom wey E promis sey E go giv doz wey luv am?
6 Bot una nor dey respet poor pipol! Nor bi rish pipol dey opres and drag una go kourt?
7 Or dem nor dey tok bad abaut Jisos name wey una biliv?
8 Bot if una du wetin dem rite for God wod, "Mak yu luv yor nebor as yu luv yorsef," una don du gud bi dat.
9 Bot if una du parsha, una dey komit sin and di law don kondem una as pipol wey nor dey du wetin dey di law.
10 Di pesin wey dey du evritin wey dey di law and e break won, don break all of dem bi dat.
11 Bikos di same God wey sey, "Nor slip wit hu yu nor mari," naim stil sey, "Nor kil enibodi." If yu nor slip wit hu yu nor mari, bot yu kil pesin, yu don break di law bi dat.
12 Mak una tok and du laik pipol wey dem go joj wit di law wey go fri pipol.
13 Jojment nor get mesi for enibodi wey nor dey mesi for odas, bikos mesi beta pas jojment.
14 My brodas and sistas, wetin dey gud if pesin sey e get fate, bot e nor dey du enitin? Dat kaind fate go fit save am?
15 If won broda or sista nor get klot to wear or fud to chop16and won of una tel am, "Mak peace dey wit yu; mak kold nor kash yu and mak yu go chop beleful, bot yu nor gi-am wetin di bodi wont, na wish kiand gud bi dat?"
17 Na so fate bi tu, if yor fate nor dey produce beta result, e go die and dey yuzles.
18 If enibodi sey,"I get fate and yu get wok." I go sey, "Mak yu show mi yor fate wey nor get wok and I go show yu my fate tru my wok."
19 Yu biliv sey na onli won gud God dey. Dimons biliv so tu and fear dey kash dem wel-wel.
20 Foolish man! Yu wont mak I show yu sey fate wey nor get wok dey yuzles?
21 Wen awa papa Abraham put en pikin Izik for di alta, wetin e du dey gud for God eye?
22 Yu nor si sey en fate and wok dey togeda and na en wok mak en fate pafet?
23 And wetin dem rite for God wod kon hapun, "Abraham biliv wetin God tok and dat won mak am gud for God eye and God kol am en frend."
24 So, pesin wok dey mak am gud tu, nor bi onli en fate.
25 Nor bi so e bi for Rahab, wey bi ashawo, wen e welkom di mesenjas, kon show dem anoda road wey dem go pas run?
26 Bodi wey nor get spirit don die, na so tu, fate wey nor get wok, don die.