Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 1
1 Na message about Judah and Jerusalem wey God show Isaiah son of Amoz during the time when Uzziah, Jotham, Ahaz, and Hezekiah be kings of Judah.
2 God talk say, "Earth and sky, make una hear wetin I dey say! The children wey I raise don go against me.
3 Cattle dey know who get them, and donkey dey know where their master dey give them food. But that pass wetin my people Israel fit know. Dem no understand at all."
4 Una don enter trouble, una nation wey like to dey sin, una wey be corrupt and evil people! Una sin don drag una go down! Una don reject the LORD, the holy God of Israel, and una don turn una back on him.
5 Why una continue to dey go against my order? Shey una wan make una punishment increase? Israel, wound don already cover una head, and una mind and heart no well.
6 Better sign no dey una body from una head to foot. Injury, sore and open wound don cover una. Una never clean una wound or bandage am. una never put ointment on top am.
7 Una country don destroy, and fire don catch una city go ground. As una dey look, foreigner take over una land and dem spoil everything.
8 Jerusalem alone remain city under attack- e no get defense like a guard hut for vineyard or like shed for cucumber field.
9 If the LORD Almighty never allow some of the people survive, Jerusalem for don destroy completely, just as Sodom and Gomorrah don destroy.
10 Jerusalem, una rulers and una people be like those of Sodom and Gomorrah. Make una listen to wetin God dey tell una. Make una pay attention to wetin God dey teach una.
11 He talk say, "Shey una think say I want all these sacrifice wey una dey always offer me? I don get pass enough of the sheep wey una dey burn as sacrifice and of fat of una fine animals. I don tire for the blood of bulls and sheep and goat.
12 Who ask una shey make una bring me all these when una come worship me? Who ask una shey make una do all this waka around for inside myTemple?
13 E dey useless to bring una offering. The smell of the incense wey una burn dey irritate me. I no fit stand una New Moon Festival, una sabbaths, and una religious gathering; una sin don corrupt all of them.
14 I hate una New Moon Festival and holy days; dem be burden wey I don tire to dey bear.
15 "When una lift una hand for prayer, I no go look una. No matter how much una pray, I no go listen, because blood don cover una hand.
16 Make una wash unaselves clean. Make una stop all this evil wey I dey see una dey do. Yes, make una stop to dey do evil
17 And make una learn to dey do right. Make una see shey una do justice- make una help people wey dey oppress, make una give orphan their right, and make una defend widow."
18 God say, "Now, make we settle the matter. Sin don stain una red , but I go wash una clean like snow. Although una stain na deep red, una go be white like wool.
19 If una go obey me, una go chop the good things wey the land dey produce.
20 But if una disobey me, una don enter trouble to die. I, the LORD, don talk."
21 The city wey dey faithful before now dey behave like prostitute! Na righteous people fill am before, but now na only killers remain.
22 Jerusalem, una be like silver before, but now una no get value; una be good wine before, but now una be only water.
23 Una leaders dey oppose and dem be friend of thieves; dem dey always accept gift and bribe. Dem no dey defend orphan for court or listen when widows dey present their case.
24 So now, make una listen to wetin the LORD Almighty, powerful God of Israel, dey say: "I go take revenge on una, my enemy, and una no go cause me trouble again.
25 I go take action against una. I go purify una like dem dey mold iron, and I go remove all una impurity.
26 I go give una rulers and adviser like those wey una get before. Then dey go dey call Jerusalem righteous, faithful city."
27 Because God dey righteous, he go save Jerusalem and everyone there wey repent.
28 But he go destroy everyone wey sin and oppose him; he go kill everyone wey forsake him.
29 Una go dey sorry shey una don worship trees and sey una don plant holy garden.
30 Una go dry like oak wey dey die, like garden wey nobody put water.
31 Just as spark dey set straw on fire, naso the evil wey powerful people dey do go destroy them, and no one go fit stop the destruction.