Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 2

1 Mak wi listin to wetin wi don hear, so dat wi nor go fal komot from di rite road.

2 Bikos di mesage wey God tok tru en angels, na trut and enibodi wey disobey di law, God go ponish am.

3 Wetin mak us sey wi go dey fri if wi nor listin to dis koret salvashon mesage? Na God first tok am and pipol wey hear am kon show us sey na trut.

4 God yuz signs, mirakols and wetin di Holi Spirit du, tak show sey, dia wods na tru.

5 God nor sey mak en angels kontrol di wold wey dey kom and wey wi dey tok abaut so.

6 Insted, David tok for God wod sey: "Wetin humanbin bi wey mak Yu dey kare for am and hu bi yor pikin wey Yu dey kare for laik dis?

7"Aldoh Yu mak angels high pas am smol. Bot Yu kon gi-am onor and glori.

8 "Yu don put evritin unda am sey mak e kontrol dem. Wen God sey na evritin E put unda am, E min sey na evritin and nor-tin rimain." And naw, wi neva si all dis tins dey hapun,

9 bot wi si Jisos wey angels big pas smol, bot e nor tu tey bifor God gi-am glori and onor, bikos e sofa and die for evribodi, jos as God plan am.

10 Dis na tru, bikos na from am and tru am evritin tak kom dis life, so dat salvashon go dey koret tru en sofa and e go kari meni pipol enta en glori.

11 Tru-tru, Jisos mak pipol dey holi, so en and di pipol wey e mak holi, na God kreate dem. Na dis mak am nor dey shame to kol dem en brodas and sistas.

12 Jisos tel God sey, "I go anounce yor name among pipol wey biliv and I go praiz Yu for dia present.

13 Kraist stil sey, "I go trust my God; both mi and di shildren wey E giv mi."

14 So as di shildren get flesh and blood, en tu get flesh and blood laik dem, so dat tru deat, e go fit distroi Satan wey get pawa to kil

15 and e go fri pipol wey deat don hol.

16 Jisos dey konsan abaut Abraham shildren and nor bi onli di angels.

17 So God mak Kraist laik us wey bi en brodas and sistas. Laik dis, Kraist go sori for us kon bi awa gud High Prist. And bikos Kraist dey konsan abaut God mata, e sakrifais ensef to rimov awa sins.

18 Bikos Jisos sofa and devol tempt am, e don get pawa to save pipol wey devol dey tempt.

Open Bible reader