Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 13

1 Mak una dey luv ish oda laik Kristen brodas and sistas.

2 Mak una always dey welkom strenja for una haus, bikos laik dis, som pipol don welkom angel enta dia haus and dem nor no.

3 Mak una rimemba doz wey dey prizin, laik sey unasef dey der wit dem and mak una rimemba doz wey dey sofa, laik sey una dey sofa laik dem.

4 Mak evribodi respet marage: una must mak sure sey una nor slip wit hu nor bi una husban or wife, bikos God go joj pipol wey dey slip wit hu dem nor mari and pipol wey don mari, wey dey slip wit oda pipol.

5 Mak una nor luv moni and mak wetin una get rish una, bikos God sey, "I nor go eva liv or abandon yu."

6 So mak wi get maind wey go mak us fit sey, "Na God bi my helpa, so wi nor go fear. Wetin humanbin go fit du us?"

7 Mak una rimemba una lidas wey tish una God wod; mak una tink abaut di kaind life wey dem dey liv, den mak una folo dia fate.

8 Jisos Kraist na di same yestiday, today and foreva, e nor dey shange!

9 Mak una nor let difren-difren prishin wey una nor no turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from fud wey dem sakrifais, bikos di sakrifais nor fit help pipol wey dey du-am.

10 Wi get alta wer di wokas for di tabanakol nor fit chop from.

11 Di High Prist dey kari anima blood enta di Holi Place as ofrin for sins, bot di anima bodi, na outsaid di camp dem for dey burn am.

12 Diafor, Jisos tak en own blood mak sakrifais, so dat en pipol go dey holi. So, Jisos Kraist kon sofa outsaid di camp tu.

13 Wi must go mit am for outsaid di camp kon share di shame wit am.

14 Bikos for here, wi nor get eni tawn wey go last, bot wi dey wait di tawn wey go kom.

15 Tru Kraist, mak wi kontinu to dey giv God praiz as awa sakrifais. So, mak wetin dey kom out from awa mout bi, "Na Jisos, bi Oga."

16 Mak una nor forget to du gud and to share wetin una get wit ish oda, bikos doz kaind sakrifais, dey mak bele swit God.

17 Mak una obey una lidas and du evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem haw dem du dia wok. Mak una let dem du-am wit hapines, nor bi wit komplain, bikos una nor go get eni beta tin from am.

18 Mak una pray for us, bikos wi dey sure sey awa maind klin and wi won liv awa life for di koret way.

19 I beg, mak una pray wel-wel, so dat dem go fri mi and I go fit kom mit una soon.

20 God wey get peace, di Pesin wey yuz di evalastin kovenant blood bring awa Oga Jisos Kraist kom bak from deat; awa Oga wey dey luk di ship,

21 mak E giv una evritin wey una nid to du wetin E wont. Enitin wey gud for en eye, mak E du-am insaid us tru Jisos Kraist. Mak all glori bi Jisos Kraist own foreva and eva. Amen!

22 My brodas and sistas, I dey beg una, mak una get patient and listin to di advise wey dey dis my leta, bikos wetin I rite, nor long.

23 Mak una no sey dem don riliz awa broda Timoti from prizin. If e kwik kom, e go folo mi kom si una.

24 Mak una grit all una lidas and all God pipol. God pipol for Itali dey grit una.

25 Mak God grace dey wit all of una.

Open Bible reader