Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Galatians 3

1 Galatia pipol, una nor get sense at-all! Hu turn una to fool naw? Bikos na for una front wi for show sey Jisos Kraist die for kros!

2 Na di tin wey I won no from una, bi dis: Una risiv di Spirit, bikos una dey du wetin di law tok or na bikos una biliv wetin wi prish giv una?

3 Na so una mumu rish? Tru-tru, una start wit di Holi Spirit, bot naw, una won finish di wok wit human-bin pawa.

4 Una sofa dis meni tins for nor-tin? Tru-tru, una rili sofa for nor-tin.

5 Wetin mak God giv una di Spirit to du mirakol? Na bikos una du wetin di law tok or bikos una biliv wetin una hear?

6 Jos as Abraham biliv God and God kol am raitious man,

7 na so tu, doz wey biliv, go bi Abraham shildren.

8 Dem rite for God wod bifor sey, "E go asept Gentai pipol, wen dem get fate" and na dis mak am tel Abraham bifor di taim rish sey, "E go bless evribodi, bikos of am."

9 So pipol wey biliv, God go bless dem togeda wit Abraham, bikos dem biliv.

10 Pipol wey dey unda di law and dem nor dey du evritin wey di law tok, dey unda kos, bikos dem rite am sey, "E nor go beta for enibodi wey nor dey du evritin wey dey di law."

11 Dis won show sey, nobodi dey gud for God eye, bikos e dey obey di law. So enibodi wey dey raitious, must liv by fate.

12 Di law nor dey bring fate, bot di pesin wey dey du wetin di law tok, go liv by wetin e dey du.

13 Kraist don save us from di kos wey di law bring, bikos e die for kros for us (jos as dem rite am, "Enibodi wey dem hang for tri, kos dey en head"),

14 so tru Kraist, Abraham blessins go kom mit Gentai pipol and wi go risiv di Spirit wey God promis us, tru fate.

15 My brodas and sistas, mak I yuz wetin dey hapun evriday for life tak mak ezampol for una: Wen pipol don mak agriment, nobodi go fit trow di agriment for kona or add enitin join am.

16 Wi no sey God mak dis promis wit Abraham and en pikin. God wod nor sey, "to di shildren", bot e sey "and to yor pikin," and e min onli won and dat won, na Kraist.

17 Na wetin I dey tok bi dis: Di law wey kom afta 430 years, nor get pawa to break di agriment and promis wey God and Abraham don mak bifor.

18 Bikos if promis dey kom tru di law, den e nor bi promis again. Bot wi no sey, na tru promis, God tak bless Abraham.

19 Na awa sin mak law dey and na so e go bi, ontil di pikin wey God promis, go kom and na tru angels, God tak giv us di law tru en profet.

20 Wi no sey pesin wey bi middleman dey stand bitwin tu pipol, bot na onli won God dey.

21 So di law dey against God promis? No! Bikos if di law dey giv pesin life, den raitiousnes go must kom tru di law.

22 Bot God wod kondem evritin and evribodi unda sin, so dat wi; di pipol wey biliv, go get God promis tru Jisos Kraist.

23 Bifor fate kom, wi dey unda di law, bikos di law hol us laik prizinas.

24 So na di law bi awa tisha bifor Kraist kom, so dat wi go fit tok sey wi dey raitious tru fate.

25 Bot since fate don kom, wi nor dey unda eni tisha again.

26 Bikos tru Jisos Kraist, all of us don bikom God shildren by fate.

27 Una wey dem don baptaiz insaid Kraist, don wear Kraist for bodi laik klot.

28 E nor mata weda una bi Ju or Greek pipol, savant or fri pesin, man or wuman, bikos all of una dey insaid won bodi for Kraist.

29 And if e bi sey una bilong to Kraist, den una bi Abraham shildren and pipol wey go inherit wetin God promis.

Open Bible reader