Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Galatians 2

1 Afta fortin years, I kon go bak to Jerusalem wit Banabas and Titus.

2 I go der bikos of di revelashon wey I risiv, den I tel dem abaut wetin I dey prish giv Gentai pipol. Bot I tok wit di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Kraist mesage.

3 Titus dey wit mi; ivun doh en na Greek pesin, dem nor sey e must sekonsaiz.

4 Dem diskos dis mata, bikos of di fake brodas wit dia wayo, wey dem tak dey spy di fridom wey Kraist giv us, so dat dem go fit mak us dia slave.

5 Bot wi nor giv dem shanse, so dat di trut wey dey di gospol, go last for una.

6 Bot doz wey tink sey dem bi oga, (wetin dem bi, nor min enitin to mi; bikos God nor dey sopot bad tin); dem wey bi lidas for di shosh nor add enitin to my mesage.

7 Bot dem kon si sey na God sey mak I prish en wod to pipol wey dem nor sekonsaiz, jos as E sey mak Pita prish to doz wey dem sekonsaiz,

8( Bikos na tru God pawa Pita tak prish to Ju pipol and na di same pawa I tak dey prish giv Gentai pipol tu),

9 so wen James, Pita and Jon wey bi lidas for di shosh, si sey God giv mi grace, dem kon dey sopot mi and Banabas sey, "Mak wi dey prish giv Gentai pipol and doz wey dem sekonsaiz."

10 Bot dem sey mak wi always rimemba poor pipol and na wetin ivun dey my maind to du, bi dat.

11 Bot wen Pita kom Antiok, I kon shalenge am, bikos wetin e du, nor gud.

12 Pita dey chop wit Gentai pipol ontil som pipol wey James send, kom rish der. As Pita si dem, e kon stop to chop wit Gentai pipol, bikos e dey fear di pipol wey kom, since dem biliv sey evribodi must sekonsaiz.

13 Oda Ju pipol kon dey pritend laik Pita, sotey Banabas join dem tu.

14 Bot wen I si sey dem nor dey du wetin dem rite for God wod, I kon tel Pita for dia front, "If yu wey bi Ju, dey du laik Gentai pipol, haw yu wont tak mak Gentai pipol liv laik Ju pipol?"

15 Wi bi Ju pipol bikos of haw dem born us and wi nor bi Gentai pipol wey bi sinas.

16 Wi no sey nobodi dey fri from God jojment, bikos na so di law tok and pipol go onli dey fri, if dem get fate for Kraist. Since wi don biliv Kraist, wi sopoz to dey du gud tru di fate wey wi get for Kraist and nor bi to dey du wetin di law tok and wi nor go dey fri from jojment, wen wi du onli wetin di law tok.

17 Mak wi dey komit sin, as wi dey trai to du gud, bikos wi get fate for Kraist? If na so, dat min sey Kraist don dey sopot sin!

18 Naw, if I dey ripair di law wey I don first skata, dat min sey I dey break God law.

19 As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alaif wit God.

20 I don die wit Kraist for kros, so nor bi mi dey liv again, bot na Kraist dey liv insaid mi. Di life wey I dey liv naw, na bikos of di gud tins wey God pikin du insaid mi, bikos e luv and die for mi.

21 I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go mak pesin gud, den Kraist die for nor-tin!

Open Bible reader