Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 36
1 God talk say: Ezekiel, son of man, tell mountain of Israel say
2 That I, the LORD God, dey talk say: una enemy look and talk say you mountains be their own.
3 Dem crush and destroy una from every side and foreign nation capture and make fun of una.
4 Make una listen to wetin I go do all you mountain and hills, stream and valley. Una land fit don destroy and nation fit dey laugh and insult una.
5 But I go turn against those nation, in my anger, especially, Edomites, because na dem laugh una pass and dem take una pastureland.
6 Una don suffer reach, and, I, the LORD God, dey vex! Nations don insult una,
7 So, I go insult and disgrace them now. Na my promise be that.
8 Tree go grow on top you mountain of Israel and go produce fruit for my people, because dem go soon come home.
9 I go take care of una by plow una soil and plant crops on top una fertile slope.
10 People of Israel go return and go rebuild una town wey don destroy and dey live for there.
11 Una go born children and animal born their young. Una no go empty again as una dey now but people go cover una and dem go treat una well pass before. Then una go know say I be God.
12 I go carry my people of Israel come home and dem go live on top you mountains, because una belong to dem and una fertile slope no go make dem hungry again.
13 Na true say people don accuse una say, una no dey produce enough food and say una dey make una people hungry.
14 But I, God, promise say una no go hear other nations dey laugh or sneer at una again.
15 From now on, una go always produce plenty food for una people. I, the LORD God, don speak.
16 God talk say:
17 Ezekiel, son of man, when people of Israel dey live for their own country, their behavoir no make land holy, just as woman monthly people dey make her unclean.
18 Dem dey kill people and dey worship idols, wey make the land worse pass before. So I punish my people with anger.
19 and I scatter dem for throughout nation, just as dem deserve.
20 Anywhere wey dem go, dem dey disgrace my name, because foreigners dey insult my people say I don force them commot for their own land.
21 I care about things wey those foreigners dey think about me,
22 so tell Israelites that I dey talk say: una don disgrace my holy name among nation where una dey live now. So una no deserve wetin I go do una. I go lead una go home so that una go bring honour to my name.
23 and to show foreign nations say I dey holy. Then dem go know say I, be the LORD God. I don talk.
24 I go gather una from foreign nations and go bring una come home.
25 I go sprinkle clean water on top una and una go clean and una go be acceptable to me. I go wash everything wey make una unclean commot, and I go remove una disgusting idols.
26 I go take away una stubborn heart and give una new heart and desire to dey faithful. Na only pure thinking una go get,
27 because I go put my spirit inside una and go make una dey hungry to dey obey my laws and my teachings.
28 Una go live in the land wey I don give una ancestors again, una go be my people, and I go be una God.
29 I go protect una from everything wey dey make una unclean. Una field go overflow with grains, and no one go hungry.
30 Fruits go full una trees, and crops go grow for una field, so that una no go shame again say una no get enough food.
31 Una go remember una evil way and una go hate una self for wetin una don do.
32 People of Israel I no dey do these things for una sake. Una sin against me, and una must suffer shame and disgrace for wetin una don do. I, the Almighty God, don talk.
33 After I don make una clean, I go let una rebuild una country wey don destroy and I go allow una live for there.
34 Una go farm una land again, and no one go see say e dey barren before.
35 Instead dem go talk say e look beautiful like garden of Eden. Dem no go see town wey destroy, but dem go see una strong city wey get plenty people.
36 Then nearby nation wey survive go know say na me wey rebuild the place wey destroy and wey replant barren field. Na I, God, make this promise.
37 I go answer una prayers again, and I go make una nation grow until una dey like plenty flock of sheep.
38 People go dey the town wey don destroy, just as sheep full Jerusalem before wey dem wan offer as sacrifice for festival. Then una go know say I be God