Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ephesians 2

1 Bifor-bifor, na stubornes and sin dey kontrol una life,

2 bikos una dey du wetin di wold wont. Una dey obey wiked pawas wey dey rule di air and kontrol stuborn shildren.

3 All of us dey liv dis kaind life bifor. Wi dey du difren tins wey awa bodi and maind wont. Dat taim, wi bi shildren wey God won ponish laik oda sinas.

4 Bikos God luv us wel-wel, E don show us plenti mesi

5( aldoh sin dey kontrol awa life bifor), E kon giv us life tru Kraist, den E save us wit en grace!

6 E raiz us up wit Kraist kon mak us sidan wit am for hevun.

7 E du dis, to show evribodi for di wold wey dey kom sey, en grace wey dey show us kaindnes tru Jisos Kraist, big wel-wel.

8 God save una wit en grace, bikos una get fate (as una don biliv Kraist), nor bi wit una own pawa, bot na God giv una.

9 E nor save una bikos of di wok wey una du, so mak nobodi dey boast.

10 God kreate us tru Jisos Kraist as di gud wok wey E don priper dan bifor, so dat wi go dey du as E plan.

11 Mak una rimemba sey bifor-bifor, una bi Gentai pipol wey dey du wetin di flesh wont and som pipol dey kol una, "pipol wey dem neva sekonsaiz" laik di way dem dey sekonsaiz humanbin.

12 Dat taim, una dey witout di Mezaya and una nor get share for Izrel blessins and since una nor get hope and una dey witout God for dis wold, una kon bi strenja to God kovenant wey E promis Izrel pipol.

13 Bot tru Jisos Kraist blood, una wey bin dey far, God don draw una near ensef,

14 bikos na Kraist bi awa peace. Na Kraist mak Ju and Gentai pipol bi won. E don break di wall wey divide and seprate dem as enimis.

15 E don kansol Ju pipol law wit all en komand and rules, so dat e go fit mak Ju and Gentai pipol to bi won wit am and laik dis, peace go dey among dem.

16 E yuz di sofa wey e sofa for kros tak end dia kworel kon mak dem won bodi as dem dey serv God.

17 And e prish peace to una wey dey far and near,

18 so dat tru am, all of us wit won Spirit, go fit rish wer awa Papa dey for hevun.

19 So, una nor go bi strenja and pipol wey nor get share for Izrel blessins again, bot una go bi God shildren wit all di pipol wey dey en haus.

20 Dis na bikos, God don build una on-top di apostols and profets foundashon and na Jisos Kraist bi di numba won stone wey God tak lay di foundashon.

21 Na for insaid Kraist di hol buildin for join togeda, kon grow as won Holi Tempol for God and

22 tru am, God don build una togeda as wer E go dey stay tru di Spirit.

Open Bible reader