Nigerian Pidgin Bible
Colossians 3
1 So, if God raiz una wit Kraist, den mak una put maind for tins wey dey hevun; di place wer Kraist for sidan for God rite side.
2 Mak una dey tink abaut tins for hevun, nor bi tins for dis eart,
3 bikos una don die and una life dey safe wit Kraist for insaid God.
4 Wen Kraist (wey bi una life) go kom, una go folo am kom wit glori.
5 So mak una kil evri bad karata wey dis wold dey bring: laik to dey slip wit pesin wey una nor mari; dey bihav enihaw; folo dis wold tins; dey du bad tins; long-trot and to serv juju.
6 Na dis tins dey mak God ves for doz wey nor dey obey am.
7 Na so una dey liv una life bifor wen una bi sinas,
8 bot naw, to dey ves enihaw; to get bad maind for pesin; to tak mout spoil pesin and to dey kos pipol, mak una rimov dem from una life.
9 Since una don kil una old sef and di tins wey una dey du bifor, mak una nor dey lai giv ish oda.
10 Mak una wear di new pesin, so dat una go dey new as una dey learn to no and bi laik di Pesin wey kreate una.
11 For hevun, e nor get enitin laik Greek or Ju pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop humanbin; slave or fri pesin, bot na Kraist bi all and e dey insaid all of us.
12 So, as pipol wey God don shuz, wey holi and wey E luv wel-wel, mak una kwik dey sori for pipol; dey gentol; nor dey kari bodi up and wear patient laik klot for bodi.
13 Mak una dey bear wit ish oda; dey forgiv ish oda; ivun doh una get wahala wit enibodi. Jos as Kraist don forgiv una, mak una forgiv odas tu.
14 Wit all dis gud tins, mak una luv won anoda, bikos na luv bi di best tin wey fit hol una togeda.
15 Mak Kraist peace dey rule una heart (bikos na tru dis peace, Kraist tak kol una as won bodi) and mak una dey tank God.
16 Mak Kraist wod stay insaid una and mak una dey tish ish oda wit wisdom wey go mak una heart strong. Mak una dey sing psalm, hymns and spiritual song and dey du all dis tins to rili tank God from una heart.
17 For enitin wey una dey du, weda una dey tok or du oda tins, mak una du-am wit awa Oga Jisos Kraist name and tank God tru am.
18 Una wey bi wife, mak una dey du wetin una husban wont, as Kraist pipol sopoz du.
19 Una wey bi husban, mak una luv una wife and nor dey wiked to dem.
20 Una wey bi pikin, mak una dey obey una papa and mama for evritin, (dey du evritin wey una papa and mama tok), bikos na wetin Kraist laik bi dat.
21 Una wey bi papa, mak una nor du wetin go mak una shildren ves, so dat life nor go taya dem.
22 Una wey bi savants, mak una obey una mastas (dey du wetin dem tok) for evritin and nor bi onli wen dem dey luk una. Mak una nor dey du laik pipol wey wont mak dem praiz dem, bot mak una dey obey wit beta maind, bikos una dey fear God.
23 Enitin wey una dey du, mak una du-am wit all una bodi, laik sey una dey du-am for Kraist and nor bi for pipol,
24 bikos una no sey God go giv una di gift wey E promis en pipol.
25 Pesin wey du bad, God go pay am bak for wetin e du, bikos God dey joj evribodi akordin to wetin dem du, since E nor dey sopot enibodi enihaw.