Nigerian Pidgin Bible
Acts 6
1 As taim dey go, wen di disaipols don plenti, di Ju pipol wey dey tok wit Greek language kon dey kworel wit di oda kontri men wey dey tok Hebrew. Dem kon dey komplain sey, "Wen dem dey share fud, di Hebrew men dey sofa wimen wey dia husban don die."
2 So di twef apostols gada evribodi kon sey, "E nor gud mak wi liv God wod wey wi dey prish kon put hand for fud mata.
3 "So mak una luk roun kon shuz among una, sevun men wey una no sey dey bihav wel, di Holi Spirit dey yuz wel-wel and wey get sense, so dat dem go du dis wok for us.
4 "So dat wi go fit put awa maind for praya, as wi dey prish God wod."
5 Evribodi laik wetin di apostols tok, so dem kon shuz won man wey en name na Steven, bikos di Holi Spirit dey yuz am wel-wel. Di odas wey dem shuz, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serv God laik Ju pipol.
6 Dem kon show dem to di apostols. Di apostols put hand for dia head kon pray for dem.
7 Na so God wod start to spread and di disaipols wey dey Jerusalem kon plenti wel-wel. And meni prists kon biliv Jisos Kraist.
8 God bless Steven wel-wel kon gi-am pawa to tak du meni wondas and mirakols among di pipol.
9 Bot som men kon dey argue wit am. Dis men dey woship God for won place wey dem dey kol "Di Freedmen Sinagog." Som of dem kom from Alexandria, Syrene, Silicia and Asia.
10 Bot dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Steven tak dey tok.
11 So, dem kon bribe som men mak dem lai sey, "Wi hear wen dis man tok tins wey dey against Mosis and God law."
12 Dem lai for Steven head, so di pipol, di eldas and di oga dem for di law kon hate am. So dem arres Steven kon kari am go di kansol.
13 Dem bring pipol kon lai sey, "E don tey wey dis man dey tok bad-bad tins abaut Mosis law and dis Tempol.
14 "Wi hear wen e dey tok sey Jisos Kraist wey kom from Nazaret go skata dis place and e go shange all di tradishon wey Mosis giv us."
15 Evribodi wey dey di kansol dey luk Steven kon si sey en face dey shine laik angel own.