Nigerian Pidgin Bible
Acts 25
1 Wen tiri days don pas, Festus komot from Sizeria go Jerusalem.
2 So di prist oga dem and all di big men among di Ju pipol kon tel am wetin dem sey Pol du.
3 Dem beg am sey mak e giv orda sey mak dem bring Pol kom Jerusalem bak, bikos dem plan to atak and kil-am for road.
4 Den Festus ansa, Pol dey for Sizeria and mi mysef go soon go der.
5 So e sey, "Mak yor lidas folo mi go der and if dis man du enitin wey bad, mak dem akiuz am."
6 Festus nor stay rish ate or ten days wen e go Sizeria and di next day, e sidan for di jojment seat kon giv orda sey mak dem bring Pol kom.
7 Wen Pol rish der, di Ju pipol wey kom from Jerusalem kon stand roun am, dey akiuz am sey e komit sin wey dem nor fit show.
8 Pol difend ensef sey, "I nor komit eni offence against di Ju law or di Tempol or against Caesar."
9 Bikos Festus won mak di Ju pipol hapi, e kon ask Pol, "Yu redi to go Jerusalem mak I joj yor kase for der?"
10 Pol ansa, "I stand for Caesar jojment seat, na here dem go joj my kase. I nor komit eni offence to Ju pipol and ivun yu yorsef no.
11 "I nor du bad and I nor komit eni offence wey dem fit tak kil mi, I nor dey trai to run sey mak dem nor kil mi, bot if evritin wey dem tok against mi nor bi tru, nobodi go fit kari mi, giv dem. I sey mak dem kari my kase go giv Caesar!"
12 Festus kon sey, "Yu don tok sey mak Caesar joj yor kase, so, na Caesar yu go-go mit!"
13 Afta som days, King Agrippa and Bernice go Sizeria, go salot Festus.
14 As dem dey der for meni days, Festus kon tel dem abaut Pol kase, so dat e go hear wetin dem go tok abaut di mata, so e kol Agrippa kon sey, "Won man dey for here wey Felix liv for prizin.
15 "Wen I dey Jerusalem, di prist oga dem and di eldas kon tel mi abaut am sey mak I kil-am.
16 "Bot I ansa dem, 'Rome law nor gri mak dem kondem enibodi wen e neva face and difend ensef bifor pipol wey dey akiuz am.'
17 "So afta dem folo mi kom here, I kon prospone di kase, bot di next day I sidan for jojment seat kon orda mak dem bring di man kom.
18 "Wen pipol wey dey akiuz am stand-up, dem nor tok eni bad tin against am as I bin suspet.
19 "Insted, dem dey argue mata wit am, abaut haw dem dey serv God and won man wey dem dey kol Jisos Kraist wey don die, wey Pol sey e stil dey alaif.
20 "Bikos I nor no haw I go tak joj di mata, I kon ask am weda e go laik go Jerusalem mak dem joj am der.
21 "Bot Pol sey mak dem tak am go Rome, so dat Caesar go joj en kase, so I kon orda sey mak dem kip am for prizin, ontil I go fit send am go mit Caesar."
22 Agrippa kon tel Festus, "Mi tu go laik hear from di man." So Festus tel am, "Yu go hear from di man tumoro."
23 So di next day, Agrippa and Bernice kon dey mak yanga enta di hall, wit all di big men wey dey di tawn. Afta Festus don giv orda, dem kon bring Pol.
24 Den Festus sey, "King Agrippa and all of una wey dey here wit us, mak una si dis man wey di hol Ju pipol dey beg mi both for here and for Jerusalem sey, mak I kil.
25 "Bot I kon si sey e nor du enitin wey go mak dem kil-am and wen e sey e won mak di emperor joj en kase, I gri sey I go send am go mit Caesar.
26 "Bot I nor no wetin I go rite go giv di emperor abaut am. So naim mak mi bring am kom all of una and king Agrippa front, so dat afta una don kweshon am finish, I go get somtin wey I go fit rite.
27 "Bikos for my maind, e nor dey rite to send prizina go kourt, wen yu nor rite wetin e du."