Nigerian Pidgin Bible
Acts 24
1 Wen faiv days don pas, Ananias, wey bi di High Prist, kom wit som eldas and won lawya wey dem dey kol Tertullus and dem read wetin dem sey Pol du, giv di govnor.
2 Wen dem orda mak dem bring Pol kom out, Tertullus tel di govnor sey, "E don tey wen wi dey enjoy peace, bikos of haw yu dey rule and all di beta-beta tins wey yu dey du tak shange di kontri.
3 "Oga Felix, wi dey si all dis tins wey yu dey du for evriwer. Na evriday wi dey tok abaut am and dey tank yu.
4 "Bot mak my stori for nor long tu mush, I beg mak yu hear us wel-wel as yu dey always du.
5 "Bikos wi don si dis man sey e faind trobol and kause wahala among all di Ju pipol for di wold and naim dey lid di gang wey dem dey kol, 'Di Nazarenes'.
6 "E ivun tak Greek pipol enta di Tempol, so wi kon arres am.
7 "Bot Lysias, di komandin ofisa kon tak am komot from awa hand wit fos.
8 "So wen yu ask am kweshon, yu go fit hear by yorsef all di tins wey wi sey e du."
9 As e dey tok, di Ju pipol tu dey sopot sey, wetin e tok, na tru.
10 Wen di govnor sey mak Pol tok, e kon sey, "I no sey yu don bi joj for dis kontri for meni years naw, so I nor go fear dey tok as I dey difend mysef.
11 "As yu go fit shek for yorsef, e neva pas twef days naw wey I go Jerusalem go woship.
12 "Dem nor si mi dey argue wit enibodi or dey gada crowd for di Tempol veranda or insaid di sinagog or ivun for di hol tawn,
13 dem nor fit show yu di offence wey dem akuiz mi sey I komit.
14 "Bot I go let yu no sey I dey woship di God wey awa gran-gran papa dem dey woship, as dia tradishon tok (wey dis pipol sey na won kaind gang). Dem biliv evritin wey di law tok and wey di profets rite dan.
15 "I get hope for God (di kaind won wey dis men get tu) sey won day, pipol wey don die, weda na bad or gud pipol, go wak-up.
16 "Na bikos of dis I dey always trai my best to get klin bele for God and pipol front.
17 "Afta meni years, I kom Jerusalem bak kon giv gift to poor pipol and offa sakrifas.
18 "Dis na wetin I dey du wen dem si mi for di Tempol; I dey klin and I nor gada eni crowd or disturb enibodi.
19 "Bot som Ju from Asia sopoz dey here dey tok di tin wey dem get against mi, if dem get enitin to tok at-all.
20 "Or mak dis men wey dey here tok di krime wey I komit as I face di kansol,
21 bikos if e pas dis won, I go shaut as I stand for dia front sey, 'Una dey joj mi today, bikos I biliv sey pipol wey don die, go wak-up.'"
22 Den Felix, wey bi sey e no di tru stori abaut di Way, prospone di kase kon sey, "Wen Lysias, di komandin ofisa kom, I go joj yor kase."
23 E kon orda di soja oga mak e gaid Pol, bot mak e gi-am smol fridom and mak e nor driv en frends if dem won gi-am enitin.
24 Afta somdays, wen Felix wit en wife Drusilia wey bi Ju, sidan togeda, dem kon sey mak dem bring Pol, so dat dem go listin to am, as e dey tok abaut haw pesin go fit tak biliv Jisos Kraist.
25 Fear kash Felix, as Pol dey tok abaut di Gud News, sef kontrol and haw God jojment go tak kom, so e kon tel Pol, "Mak yu go first, wen I get taim, I go sey mak dem bring yu kom again."
26 Bikos e dey hope sey Pol go bribe am, naim mak am sey mak dem bring Pol kom mit am meni taims.
27 Afta tu years, Porcius Festus tak ova from Felix and bikos Felix won mak di Ju pipol hapi, e kon liv Pol for prizin.