Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 18

1 Afta dis tins, Pol komot from Atens go Korint.

2 For der, e kon si won Ju wey dem dey kol Akwila, wey kom from Pontus and e jos kom bak from Itali wit en wife Prisila, bikos Klaudios orda sey mak all Ju pipol komot from Rome. Pol go mit dem

3 and bikos dem dey du di same wok, e kon stay wit dem dey folo dem wok (na tent dem dey mak sel).

4 E dey tok to both Ju and Greek pipol for di sinagog evri Sabat, so dat dem go biliv.

5 Wen Silas and Timoti kom from Masidonia, Pol kon yuz all en maind dey prish di wod, dey bear witnes giv di Ju sey, na Jisos bi di Kraist.

6 Wen dem opoz and kos am, e shake en dress kon sey, "Mak una blood dey una head, bikos I nor du eni bad tin and from today go, I go-go prish for Gentai pipol!"

7 Den Pol komot for di sinagog go Titus Justus haus; di man na Gentai wey dey woship God and en haus dey near di sinagog.

8 Krispus, di oga for di sinagog and en famili, plus meni Korint pipol wey hear abaut Jisos Kraist, biliv and dem kon baptaiz dem.

9 Jisos kon tel Pol for vishon for nite, "Mak yu nor kwayet bikos of fear, bot mak yu opun yor mout dey tok,

10 I dey for yor side and nobodi go fit du yu enitin, bikos I get plenti pipol for dis tawn."

11 So e stay der for won year and sis monts dey tish di pipol God wod.

12 Wen Gallio dey rule for Akaya, Ju pipol join togeda atak Pol kon kari am go di jojment seat.

13 Dem sey, "Dis man dey bribe pipol to woship God and dat tin dey against awa law!"

14 Bot jos as Pol won start to tok, Gallio kon tel di Ju pipol sey, "If na bikos of won offens or serious wayo, I for listin to una komplain,

15 bot since na mata abaut wod, name and una own law, mak una go setol am by unasef. I nor go joj all doz kaind tins!"

16 So e driv dem komot from di jojment seat.

17 Dem kon sieze Sostenes, wey bi oga for di sinagog kon start to beat am for di jojment seat front. Bot Gallio du laik sey all dis tins nor konsan am.

18 Afta e don stay meni days for Korint, Pol kon tel all di brodas bye-bye, den e enta ship go Syria and Prisila and Akwila folo am go. For Senkria, e kon kut en hair bikos e mak vow.

19 Wen dem rish Efisos, Pol kon liv Prisila and Akwila for der, bot en ensef enta di sinagog go folo di Ju pipol tok.

20 Wen dem sey mak e stay wit dem smol, e nor gri,

21 bot e tel dem bye-bye kon sey, "If God wont, I go kom again kon si una." Den e enta ship from Efisos

22 and wen e rish Sizeria, e pas go Jerusalem go salot di pipol for di shosh wey dey der, bifor e go Antiok.

23 Afta e don stay smol for der, Pol komot kon travol pas all di aria wey dey Galatia and Frigia, dey enkorage all di disaipols.

24 E get won Ju man, en name na Apollos and e from Alexendria go Efisos. Apollos sabi tok and e no di Bibol wel-wel.

25 Dem don tish am abaut Jisos and na wit high spirit e tak dey tok and tish abaut Jisos Kraist, bot na onli Jon baptism, e no rish.

26 E kon dey tok wit boldnes for di sinagog, bot wen Prisila and Akwila hear am dey tok, dem kol am go kona kon explain God wod giv am wel-wel.

27 Wen Apollos won kros go Akaya, di brodas enkorage am kon giv am leta mak e giv di disaipols, so dat dem go welkom am. Wen e rish der, e kon join dey help di bilivas,

28 bikos e nor gri wit wetin di Ju pipol dey tok for publik and e show dem from di Bibol sey na Jisos Kraist, bi di Mezaya.

Open Bible reader