Nigerian Pidgin Bible
Mark 3:23
So Jisos kon tok to di pipol for parabol sey: "Haw Satan go fit tak driv Satan komot? 24" Eni kindom wer pipol dey fite ish oda, nor go fit stand. 25" And eni famili wey dey fite demsef, go skata. 26" So, if Satan kindom divide against ensef, e nor go fit stand and en end don rish. 27" Nobodi go fit enta strong man haus tif en propati, unles e first tie di strong man, bifor e go fit tif en tins. 28" I tel una tru wod, God go forgiv pipol di sins wey dem komit and all di bad wod wey dem tok. 29" Bot enibodi wey tok bad wod against di Holi Spirit, God nor go eva forgiv am, bikos e don komit sin wey go last foreva."
Open Bible reader