Nigerian Pidgin Bible
Mark 3
1 Wen Jisos enta di sinagog again, won man wey en hand die, dey der.
2 Di Farisi pipol kon dey luk Jisos wit kona eye weda e go heal di man for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go tak akuiz am.
3 So Jisos tel di man, "Mak yu stand for senta mak evribodi si yu."
4 Jisos kon ask, "E gud mak wi du gud or bad tin for Sabat Day? Mak wi save or distroi pesin?" Bot dem nor ansa.
5 So Jisos ves kon luk dem roun, bikos dia heart strong wel-wel, den e tel di man, "Stresh yor hand." So di man stresh en hand and di hand kon wel again.
6 Den di Farisi and Herod pipol kon kwik-kwik go outsaid go plan haw dem go tak kil Jisos.
7 Den Jisos komot wit en disaipols go di wotasaid and plenti pipol from Galili folo am. Pipol from Judea,
8 Jerusalem, Idumia, som from akros Jordan Riva and aroun Tyre and Sidon kom mit am wen dem hear abaut di tins wey e dey du.
9 Bikos of di pipol, Jisos kon tel en disaipols mak dem priper won smol boat for am, so dat pipol nor go push am enihaw.
10 Jisos kon heal meni pipol, so all di pipol wey nor wel kon dey push ish oda, so dat dem go fit tosh am.
11 And enitaim evil spirit wey dey insaid som pipol bodi si Jisos, dem go fal for en front dey shaut, "Yu bi God Pikin."
12 Bot Jisos kon warn dem wel-wel mak dem nor let pipol no hu e bi.
13 Jisos klimb go on-top mountin kon kol di pipol wey e wont, mak dem kom mit am for der.
14 E kon shuz twef (wey e kol apostols), so dat dem go dey wit am and e go fit send dem go prish.
15 E kon giv dem pawa to driv dimons komot.
16 Na di twef wey e shuz bi dis: Saimon wey e kol Pita,
17 James and en broda Jon wey bi Zebedi shildren wey Jisos dey kol "Boanerges (wey min 'Thunda shildren');"
18 plus Andru, Filip, Batlomi, Matiu, Tomas, James wey bi Afius pikin, Tadius, Saimon wey dem dey kol Zilot (pesin wey dey fite for en kontri),
19 and Judas Iskarot, wey sel Jisos giv en enimis.
20 Jisos go haus and plenti pipol kon gada am sotey en and en disaipols nor fit chop.
21 Wen Jisos famili hear wetin dey hapun, dem kon go hol am, bikos pipol dey sey, "E don dey krase."
22 Di law tishas wey kom from Jerusalem sey, "Belzibub dey insaid am" and "Na dimon pawa e tak dey driv dimons komot from pipol bodi."
23 So Jisos kon tok to di pipol for parabol sey: "Haw Satan go fit tak driv Satan komot?
24" Eni kindom wer pipol dey fite ish oda, nor go fit stand.
25" And eni famili wey dey fite demsef, go skata.
26" So, if Satan kindom divide against ensef, e nor go fit stand and en end don rish.
27" Nobodi go fit enta strong man haus tif en propati, unles e first tie di strong man, bifor e go fit tif en tins.
28" I tel una tru wod, God go forgiv pipol di sins wey dem komit and all di bad wod wey dem tok.
29" Bot enibodi wey tok bad wod against di Holi Spirit, God nor go eva forgiv am, bikos e don komit sin wey go last foreva."
30 Jisos tok so, bikos som pipol sey, "Evil spirit dey insaid am."
31 Jisos mama and en brodas kom mit am. Dem stand for outsaid kon send pesin go kol am.
32 Di pipol wey sidan near Jisos kon tel am, "Yor mama and yor brodas dey outsaid, dem won si yu."
33 Bot Jisos ansa dem, "Hu bi my mama and my brodas?"
34 Den e kon luk di pipol wey sidan roun am, tel dem, "Na my mama and my brodas bi dis pipol!
35" Bikos enibodi wey du wetin God wont, na-im bi my broda, sista and mama."