Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 66:3
The people do as dem like. Na the same thing e be to them whether dem kill bull as sacrifice or kill human being as sacrifice; whether dem sacrifice lamb or dem break neck of dog; whether dem present grain offering or dem offer blood of pig; whether dem offer incense or dem pray to idols. Dem dey enjoy ways of worship wey no make sense.
Open Bible reader