Nigerian Pidgin Bible
Romans 8
1 So, God nor go kondem pipol wey biliv Jisos Kraist.
2 Since di Holi Spirit don giv una life wey kom from Jisos Kraist, e go fri una from sin and deat.
3 Mosis law nor fit du dis tins, bikos di yeye life wey wi dey liv don mak di law wik. Bot God don fri us wen E send en pikin kom laik humanbin wey bi sina, mak e for sakrifais ensef for awa sins.
4 God du so, so dat wetin di law tok, go hapun wen wi obey di Spirit, insted of awa own maind.
5 Bikos pipol wey dey liv by dia own maind, dey tink of onli demsef. Bot evribodi wey di Holi Spirit dey rule, dey tink of tins wey di Spirit wont.
6 If wi let sin rule awa maind, wi go die. Bot if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace.
7 Pipol wey dey sin, na God enemi dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.
8 Doz wey dey obey sin, nor go fit mak God hapi.
9 Bot una nor dey obey sin, insted, na as di Spirit sey mak una liv, na so una dey liv.
10 Kraist dey liv insaid una. So una dey alaif, bikos God don asept una, ivun doh una bodi must die, bikos of una sins.
11 If God Spirit wey raiz Jisos Kraist from deat dey insaid una, den en wey raiz Kraist from deat, go giv una bodi life, bikos of en Spirit wey dey insaid una.
12 So my brodas and sistas, wi get wok to du for God, so mak wi nor liv as awa bodi wont.
13 Bikos if una dey folo sin, una go die. Bot di Spirit pawa go kil all di bad tins wey una dey du, so dat una go get life.
14 Na doz wey God Spirit dey lid, bi God shildren.
15 Di Spirit wey God giv us nor go mak us fear laik slave, insted, wi bi God shildren and wi dey kol am, "Awa Papa!"
16 Na God Spirit mak us no sey wi bi God shildren.
17 And if wi bi God shildren, den wi go inherit God propati. Yes, wi go folo Kraist inherit God propati, bikos if rili wi sofa wit am, wi go folo am enjoy.
18 I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, wit di glori wey God go giv us.
19 Evritin wey God kreate for dis wold, dey wait for God to show en shildren to di wold.
20 Bikos of sin, di wold dey sofa from God kos naw and nor bi bikos dem wont am laik dat. Bot di wold dey hope
21 sey won day, God go fri dem from deat and wahala and dem go-go join en shildren wey E don save.
22 Wi no sey evritin wey God kreate, dey krai, jos laik di way wuman wey won born dey krai.
23 Di Holi Spirit don mak us dey sure of haw tumoro go bi. Bot naw, wi dey strogol as wi dey wait mak God show sey wi bi en shildren, den E go kon save us.
24 Na dis hope save us. Bot if wi don alredi get wetin wi dey hope for, den wi nor nid to dey hope again. Abi hu dey hope for wetin e don alredi get?
25 Bot if wi put hope for wetin wi nor fit si, wi go tak all awa maind wait for am wit patient.
26 Na so tu di Holi Spirit dey help us bikos wi dey wik. Bikos wi nor no wetin wi sopoz to pray for, di Spirit by ensef dey krai beg God, for di way awa wod nor go fit esplain.
27 And God wey dey si evritin insaid awa bele, no wetin dey di Spirit maind, bikos di Spirit dey pray for all God pipol, as God wont.
28 And wi no sey evritin dey wok for awa gud, bikos wi luv God and dey du wetin E wont.
29 God no doz wey E don shuz, so E don mak dem bi laik en Pikin, so dat en pikin go bi di first born.
30 Doz wey God don asept, na dem E kol; doz wey E kol, na dem E mak raitious and E kon share en glori wit dem.
31 Wetin wi go tok abaut all dis tins? If God dey for awa side, hu go fit dey against us?
32 Tru-tru, if E let dem kil en own pikin for awa sins, den E go fit giv us evritin wey wi ask from am fri of charge!
33 Hu go fit akiuz pesin wey God don shuz? Na God no hu gud or bad.
34 Hu bi di pesin wey go kondem us? Na Jisos Kraist wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us.
35 Na hu go fit seprate us from Kraist luv? Na trobol or opreshon; hunga or poverti; wahala or deat; or na bikos klot nor dey to wear?
36 As dem rite am, "Bikos of una, wi dey face deat from mornin go rish nite, wi bi laik ship wey dem won go kil."
37 Insaid all dis tins, awa joy don dey ful, bikos Jisos luv us!
38 Bot I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di wons wey dey kom;
39 tins wey dey hevun; tins for unda dis eart or enitin wey God kreate, non of dem go fit seprate us from God luv, bikos of Jisos Kraist wey bi awa Oga.