Nigerian Pidgin Bible
Romans 6
1 So wetin wi go tok? Mak wi kontinu to dey sin so dat God grace go dey wit us?
2 No! Why wi wey don turn from sin go stil dey liv insaid am?
3 Abi una nor no sey all di pipol wey dem baptaiz insaid Kraist don die wit am?
4 Dem bere us wit am wen wi baptaiz, so as God raiz Kraist from deat tru en pawa wit glori, na so wi tu go get life wey nor dey end.
5 Bikos if wi don die wit Jisos Kraist tru baptism, God go raiz us up wit am.
6 Wi no sey di pesin wey wi bi bifor, dem don nail am for kros wit Jisos. So awa bodi nor bi sin savant again.
7 Bikos pesin wey don die, don fri from sin.
8 As wi die wit Kraist, wi biliv sey wi go liv wit am.
9 Wi no sey since God don raiz Kraist up, e nor go die and deat nor get pawa for en bodi again.
10 Bikos as e die, e don ovakom sin foreva, so di life wey e dey liv naw, e dey liv am for God.
11 So mak una no sey, una don ovakom sin tu and una get life tru Jisos Kraist.
12 Derfor, mak una nor alow sin kontrol una bodi again, so dat una nor go dey du bad tins.
13 Mak una nor let Satan yuz una bodi tak du bad tins, bot mak una kari unasef giv God as pipol wey don wak-up from deat, so dat una go dey du gud tins.
14 Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey unda di law again, bot na God grace dey kontrol una naw.
15 So na wetin wi go tok? Mak wi stil dey sin, bikos wi get God grace and wi nor dey unda di law again? God forbid!
16 Yu nor no sey wetin yu giv yor bodi to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, bot if na God, E go mak yu dey liv raitious life.
17 Bot wi tank God sey, ivun doh una bi slave to sin bifor, una don yuz una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.
18 And as e bi sey una don fri from sin, una don bikom slave to gud tins.
19( I dey tok wit humanbin sense, bikos I no sey una dey wik.) Bifor, una dey giv una bodi laik slave to bad tins, bot naw, una must yuz una ful bodi tak serv God, so dat una go dey du onli wetin God wont.
20 Bikos wen una bi sin savant, una nor nid to dey raitious.
21 So wetin una gain from all doz bad tins wey una du? Na shame and deat doz tins dey bring.
22 Bot naw, una don dey fri from sin kon bi God savant. Dis go mak una dey holi and God go giv una life wey nor dey end.
23 Bikos, di riwod for sin, na deat, bot God gift wey Jisos Kraist dey giv us, na life wey nor dey end.