Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 5

1 Since fate don mak us dey gud for God eye, wi don get peace tru awa Oga Jisos Kraist.

2 Na fate e tak buy us so dat wi go enta God grace, di place wer wi dey naw. So wi fit boast wit God glori wey wi dey enjoy.

3 Wi stil dey hapi insaid di wahala wey wi dey face, bikos wi no sey trobol go mak us endure,

4 and endurance dey bring gud karata, wey go mak us get hope.

5 Dis hope nor dey disappoint pesin at-all, bikos God pour en luv laik riva wey dey flow insaid awa heart, tru di Holi Spirit wey E giv us.

6 For di taim wen wi nor fit help awasef, Kraist kon die for us wey bi sinas.

7 Nobodi go won die for anoda pesin wey dey gud for God eye, aldoh sombodi go fit die for pesin wey gud wel-wel.

8 Bot God show haw en luv for us big rish, wen E send Kraist kom die for us, ivun doh wi stil dey sin.

9 Naw, wi dey rite bikos of Kraist blood and na dis blood go save us from God vesnashon.

10 Wi bi God enimis bifor, bot E don mak us en frends tru en Pikin deat. Naw, since wi don bi God frends, E go save us tru di life wey en pikin get.

11 Nor bi onli dis won mak us dey hapi, bot wi stil dey hapi bikos of wetin God don du tru awa Oga Jisos Kraist wey mak us bi God frends.

12 Na tru won man sin enta dis wold and deat kom tru sin. So wi must die, bikos evribodi don sin.

13 Sin dey di wold bifor di law kom, bot if law nor dey, wi nor go fit joj pipol sin.

14 From Adam kon rish Mosis taim, na deat dey rule for dis wold, ivun doh nor bi evribodi disobey God komand laik Adam. Dis Adam bi laik Kraist wey kom leta.

15 Bot tu of dem nor bi di same, bikos God fri gift nor bi laik Adam sin. Na tru sey meni pipol die, bikos of won man sin. Bot God grace big wel-wel and e dey giv fri gift to pipol tru en pikin Jisos Kraist!

16 God gift and won man sin nor bi di same. Jojment folo di won man sin kon kondem evribodi, bot na God gift dey fri us, ivun doh wi bi sinas.

17 Bot if na bikos of won man sin deat kil evribodi, naim bi sey, doz wey don get favor and Kraist gift, dey gud for God eye and dem go enjoy life tru Jisos Kraist!

18 God go ponish evribodi bikos of Adam sin. Bot bikos of di gud tins wey Jisos du, God don asept and giv us di gift wey dey giv life.

19 Bikos Adam nor obey God, meni pipol bigin sin. Bot since Jisos obey God, meni pipol go obey God tu.

20 Di law kom so dat sin go inkrease, bot wer sin get pawa, God grace strong pas am

21 and as sin dey kontrol us tru deat, na so God grace dey rule tru raitiousnes wey dey bring life wey nor dey end, bikos of Jisos Kraist wey bi awa Oga.

Open Bible reader