Nigerian Pidgin Bible
Philippians 4
1 My brodas, sistas and frends wey I luv, I dey hungri to si una, bikos una dey mak mi proud. My frends wey I luv, mak una stand wel insaid Kraist!
2 I dey beg Udia and Sintike mak dem agri togeda insaid Kraist.
3 Yes, my gud frends, I stil dey tel una, mak una help dem. Dem trai as dem dey prish di gospol wit mi, both Klement and my oda co-wokas, wey dia name dey insaid Kraist Life Book.
4 Mak una always dey hapi insaid Kraist. I dey tok again sey, mak una dey hapi!
5 Mak evribodi no sey una nor laik wahala, bikos Jisos go soon kom.
6 Mak una nor let enitin wori una for maind. Insted, for evri kondishon wey una dey face, mak una ask God tru praya for evritin wey una nid and mak una always dey tank am, as una dey pray.
7 Den God peace wey pas wetin humanbin fit undastand, go gaid una heart and maind insaid Kraist.
8 Finali, my brodas and sistas, tins wey bi tru; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok gud abaut; wey gud wel-wel; wey rish to praiz; na dis kaind tins una sopoz to dey tink abaut.
9 So enitin wey una learn, hear and si mi dey du, mak una dey du dem tu. And di God wey dey giv us peace, go dey wit una.
10 I dey hapi wel-wel insaid Kraist, bikos una don finali show sey, una dey tink abaut haw I dey manage. (I no sey una get mi for maind bifor, bot una nor get shanse to du enitin for mi).
11 I nor dey tok dis won bikos I nid enitin, bot na bikos I don learn to dey okay for eni kondishon wey I si mysef.
12 E get somtaim wey I nor get and somtaims, I dey get plenti. Bot for evri kondishon, I don learn haw to dey okay; weda my bele ful or I dey hungri; weda I get plenti or I nor get enitin at-all.
13 I fit du evritin tru Kraist wey dey giv mi pawa.
14 Bot una trai wel-wel as una help mi wen I dey trobol.
15 Filipai pipol, una no sey, wen I komot from Masidonia, for di taim wen I jos start to prish di gospol, na una bi di onli shosh wey help mi and na onli una dey folo mi share for my hapines and sofa.
16 Bikos ivun for Tesalonika, una stil send tins kom giv mi.
17 I nor dey tok dis bikos I wont gift, bot mak una for gain from dis wok wey una dey du.
18 Naw, I get evritin wey I nid, bikos Epafroditus don giv mi di tins wey una send. And na dis bi di ofrins wey dey mak bele swit God.
19 My God go giv una evritin wey una nid, bikos of en glori and rishis wey dey insaid Jisos Kraist.
20 Mak evribodi giv glori to God awa Papa, foreva and eva. Amen.
21 Mak una grit God pipol wey dey for Kraist.
22 God pipol wey dey here dey grit una tu, especiali doz wons wey kom from Caesar haus.
23 Mak awa Oga Jisos Kraist grace dey wit una spirit.