Nigerian Pidgin Bible
Numbers 33
1 As Israel dey travel from Egypt under command of Moses and Aaron,
2 Moses keep list of the places wey dem set up camp, just as God don command. Na the record of their journey be this:
3-4 Israel leave Egyptian city Rameses on fifteenth day of the first month. Na the day after the LORD don punish Egypt gods as he kill every first-born son of every Egyptian family. So, as Egyptians dey bury the bodies, dem watch the Israelites as dem dey leave their country with pride.
5 After Israelites leave Rameses, dem camp at Succoth,
6 and from there, dem move their camp to Etham for edge of the desert.
7 Dem come turn back toward Pi-Hahiroth, east of Baal-Zephon, and dem camp near Migdol.
8 Dem leave Pi-Hahiroth, Cross Red Sea, and dem trek for three days enter Etham Desert and camp for Marsh.
9 Dem camp next for Elim, where 12 springs of water and 70 palm trees dey.
10 Dem leave Elim and camp near Red Sea,
11 dem come turn east and camp along western edge of Sinai Desert.
12-14 From there, dem go to Dophkah, Alush, and Rephidim, where dem no get water.
15 Dem leave Rephidim and finally reach Sinai Desert.
16-36 As Israel travel from Sinai Desert to Kadesh for Zin Desert, dem camp for Kibroth-Hattaavah, Hezeroth, Rithmah, Rimon-Perez, Libnah, Rissah, Kehelathah, Mount Shepher, Haradah, Makheloth, Tahath, Terah, Mithkah, Hashmknah, Moseroth, Bebe-Jaakan, Hor-Haggidgad, Jotbathah, Abronah, Ezion-Geber, and finally Kadesh.
37 When dem leave Kadesh, dem reach Mount Hor, for border of Edom.
38 Na where God command Aaron the priest make he go on top mountain be that. Aaron die for there on the first day of fifth month, 40 years after Israelites don leave Egypt.
39 Na 123 years old he be, at that time.
40 Na that time the Canaanite king of Arab, wey dey live for Southern Desert of Canaan, hear say Israel dey go that way.
41-47 The Israelites leave Mount Hor and begin dey go Moab. As dem dey go, dem camp for Zalmonah, Punon, Oboth, Iye-Abarim for territory of Moab, Dibon-Gad, Almon-Diblathaim, at a place near Mount Nebo for Abarim Mountains,
48 and finally for lowlands of Moab across Jordan River from Jericho.
49 Their camp extend from Beth-Jeshimoth to Acacia..
50 As Israel camp for lowlands of Moab across Jordan River from Jericho, God tell Moses
51 make he give people of Israel this message: When una cross Jordan River and enter Canaan,
52 make una chase the people wey dey live there commot. Destroy their idols and tear their altars down.
53 Make una settle for the land I don give am to una as una own.
54 I go show una how una go share the land among the tribes, according to number of clans for each tribe, so that large tribe go get more land pass small tribes.
55 If una no force out all people wey dey there, dem go be like pin wey person chook for una eye and thorns for una back. Dem go always be trouble for una,
56 and I go treat una very bad like I don plan to treat them.