Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 9

1 Jisos enta boat, kon kros go en home-tawn for di oda side.

2 Some pipol kon bring won man wey nor fit waka kom mit am. Wen Jisos si as dia fate strong rish, e kon tel di man wey nor fit waka, "My pikin, mak yu nor fear! God don forgiv yu all yor sins. “

3 Den som law tishas kon dey tink for dia maind sey, "Si as dis man dey shalenge God. “

4 Wen Jisos no wetin dem dey tink, e kon ask dem, "Wetin mak una dey tink dis kaind bad tin for una maind?

5 “Wish won eazi pas to tok, 'I forgiv yu yor sins' or 'Stand up mak yu dey waka?'

6 “Bot mak una no sey Man Pikin get pawa for dis wold to forgiv pipol dia sin. “So e kon tel di man wey nor fit waka, "Stand up, kari yor bed, mak yu dey go yor haus. “

7 Den di man stand up kon waka go en haus.

8 Wen di pipol si wetin hapun, dem sopraiz wel-wel, kon bigin praiz God wey giv dis kaind pawa to humanbin.

9 As Jisos komot from der, e si won man wey en name bi Matiu, wey sidan for wer dem for dey pay tax. Jisos kon tel am, "Folo mi. “At wons, di man kon get up folo am.

10 As Jisos dey chop for Matiu haus, meni tax koletors and sinas folo en and en disaipols dey chop tu.

11 Wen di Farisi si wetin dey hapun, dem kon bigin ask di disaipols, "Wetin mak una tisha dey folo tax koletors and sinas dey chop? “

12 Wen Jisos hear wetin dem dey tok, e kon ansa dem, "Pesin wey wel nor nid doktor to kior am, bot na onli hu nor wel, nid am.

13 “Mak una go learn wetin dis wod min, 'Na mesi I wont, nor bi sakrifais, na sinas I kom save, nor bi gud pipol. “

14 Jon disaipols kom mit Jisos kon ask am, "Why e bi sey wi and di Farisi pipol dey fast evritaim and yor disaipols nor dey fast? “

15 Jisos kon ansa, "Pipol wey kom marage dey mourn if di man wey dey mari dey wit dem? E nor dey hapun laik dat! Bot di day go kom wen dem go tak di man wey dey mari komot from wer dem dey, dat taim, dem go fast.

16 “Nobodi dey tak new klot pash di hole wey dey for old klot, bikos wer dem pash for di old klot go tear more and di hole wey go dey der, go big pas di won wey dey bifor.

17 “Nobodi go pour new wine insaid old wine bag, bikos di bag go burst and di wine go pour trowey, den di wine bag go tear. Na dis mak dem dey put new wine insaid new wine bag, so dat di wine nor go trowey and di wine bag nor go tear. “

18 As Jisos dey tok dis tins, won oga kom nil dan for en front kon sey, "My dota jos die, mak yu kom tosh am and e go wak-up. “

19 So Jisos and en disaipols kon folo am.

20 Won wuman wey blood dey rush komot for en bodi for twef years kon tosh Jisos klot.

21 Bikos di wuman tink for en maind sey, "If I go fit tosh en klot kona, I go wel. “

22 Wen Jisos turn round si di wuman, e kon tel am, "My pikin, mak yu nor wori! Yor fate don mak yu wel. “From dat taim, di wuman kon wel.

23 Wen Jisos enta di oga haus, e si pipol dey play mizik and plenti pipol dey mak nois for der.

24 E kon tel dem, "Mak evribodi komot, di girl nor die, e jos dey slip. “Den, dem kon bigin laff am.

25 Afta di pipol don go outsaid, Jisos go hol di girl for hand and di girl kon stand up!

26 Pipol kon bigin tok wetin hapun so for evriwer.

27 As Jisos komot for der, tu blind men kon folo am dey shaut, "David pikin, mak yu sori for us! “

28 Wen Jisos don enta di haus, di tu blind men kom mit am. Den e ask dem, "Una biliv sey I fit mak una si? “Dem kon ansa, "Yes, yu fit. “

29 Den Jisos tosh dia eyes kon sey, "Mak e hapun to una as una fate strong rish. “

30 At wons, dia eyes kon opun and dem kon bigin si. Jisos kon warn dem sey, "Mak una nor tel enibodi wetin hapun so. “

31 Bot dem kon go evriwer, bigin tok abaut di tin wey Jisos du for dem.

32 As dem komot, som pipol bring won man wey get dimon and e nor fit tok, kom mit Jisos.

33 Wen Jisos don driv di dimon komot, di man kon bigin tok. Di pipol wey gada for di place sopraiz wel-wel and dem kon sey, "Nobodi don si dis kaind tin for Izrel bifor. “

34 Bot di Farisi pipol sey, "Na devol pawa Jisos dey yuz tak driv dimon komot from piopl bodi. “

35 Jisos waka go all di tawn and vilage, dey prish di Gud News abaut God Kindom for dia sinagog and dey heal difren diziz and siknes.

36 Wen e si haw pipol plenti rish, e kon sori for dem, bikos nobodi dey to help dem and dem kon dey waka enihaw laik ship wey nor get hu dey luk dem.

37 Den e tel en disaipols, "Wetin pipol go havest plenti wel-wel, bot di pipol wey go du di wok nor plenti rish.

38 So, mak una pray mak di Oga wey get di farm, send pipol wey go wok for en farm, kom.”

Open Bible reader